Prophecy 55, WARN DI PEOPLE Say TOTAL DESTRUCTION DEY COME


Prophecy 55
WARN DI PEOPLE! Say TOTAL DESTRUCTION DEY COME!!!

Na under di anointing nain
Rev. Apostle Elisabeth Sherrie Elijah (Elisheva Eliyahu) take speak dis prophecy and na so dem take write am for here

 [Dis very prophecy from YAHUSHUA includes lessons in diligently seeking di Lord, a dream wey HIM call on HIS Apostles and Prophets to read and interpret, not to allow a quenching of di anointment, and a sterious warning to those wey HE dey call to support dis ministry wey dey ignore HIS Voice.]

* * * * * * *

(Dis na from Prophecy 105, YAHUVEH say to put dis up for all Prophecies from now on: I warn you a long time ago Elisabeth [Elisheva], make you no call dis Ministry after a man or a woman name.
Even before dis Ministry start, I put am for your spirit. Becos nothing wey dey here come from your hand.Nothing wey dey here commot from your mouth. Na from di Mouth of YAHUVEH dis take come out. Na from di Mouth of YAHUSHUA, your MASHIACH, na dis take come out.
Na from di Mouth of di RUACH HA KODESH, your IMMAYAH, na dis take come out. If to say na by your hand e for don fail long time ago. Na by di SHKHINYAH GLORY Wind
wey dey blow across dis earth, di HOLY Wind of Revival. No be by your breath, or e for don fail. ( Isaiah 42:8)

For July 2010, YAHUVEH GOD also say to add di following as a warning to those wey dey mock:
But dem mock di Messengers of GOD, despised HIS Words,
and no take HIS Prophets serious, until di Wrath of YAHUVEH
arise against HIS People, till there was no remedy.
      —2 Chronicles 36:16

* * * * * * *

Prophecy Begins


MY beloved [children], you dey always remind ME say I dey chastise and rebuke those wey I love. But MY beloved, do you not realize say I also dey reward diligently those wey dey seek after ME. You dey diligently, 24 hours a day, even for your sleep, you dey diligently seek after ME. How much more wey I go reward MY Children wey dey diligently seek after MY every word?
Total Destruction dey come. Get ready. Total Destruction dey come. That na why I dey tell MY Daughter now; speak am out in words. No be only in di power of di word wey dem write down. Years ago I commanded say make make dem speak out dis words, and yet I know say di [former] site managers no go obey. Now na di time, though. Dis prophetic words dey speak forth. Each day a new one will be added. All of dem go dey for where dem go hear dem, no be only to read.

Total Destruction dey come. Find that dream, di last one wey I give MY Daughter. Devastation is coming. Name am dis name. Warn di people. Tell dem say I dey send forth MY Apostles and Prophets to warn di people before destruction go come. Destruction dey come but not to MY Babies, not to MY Bride, not to MY Chosen Ones and not to MY Elect, I AM going to protect dem just as surely as I take protect Noah and his family in di ark, if dem can just believe. Tell dem, say I go protect dem from di flood of ungodliness. I go protect dem from di flood of di dangers wey soon to come.

Tell dem, “Get inside di Ark.” Find out where di ark go dey. Tell dem to seek MY face. If dem no know where di ark go be, fast and pray and wail and lament but find out where their ark dey. As long as dem dey aware of where dem supposed to be, as long as dem dey under di umbrella of MY safety, then dem dey inside their ark, no matter where dem dey in di world. But I tell you again, MY Children, call forth di Apostles and Prophets to interpret di dream wey I give Elisabeth [Elisheva].
TOTAL DESTRUCTION DEY COME!

You must post di dream and I go give you one interpretation of di dream. But call forth di Apostles, and call forth di Prophets, for each one go have a part if dem go but obey and dem go tell you di full revelation of that dream. Becos MY Children di heathen dey bring destruction and I allow am. But those wey cry out to ME, in MY SON YAHUSHUA’s Name, dem go dey inside di ark of MY safety, I go protect dem from destruction and pain. Put dis date and time down in big letters also with di dream and tell dem, just as in di days of Noah, just as in di days of Lot.

TOTAL DESTRUCTION DEY COME!!!

You no know which hour. You no know what day. But on a Sabbath day. [Telephone dey ring for background.] You better dey in prayer! Message of total destruction – Interruption Quench di Anointing – Warning [Elisabeth (Elisheva) dey distracted by di ringing telephone, she continue to pray in tongues.] And where your faith dey, nain your safety shall be. Your safety no be. [dem dey leave Message for answering machine.] Chastisement For Allowing di Anointing To Be Quenched Next time, MY Children, learn a lesson. Unplug that phone. Never again take di chance di anointing can be quenched. [Elisabeth (Elisheva) continue to pray in tongues, she dey struggle to get her attention back on wetin YAHUSHUA dey speak to her.]

Dis make ME angry. Next time make you take care. Brother ***** did not know. He no understand say di hands of satan use him. I forgive you, but dis na another lesson how easily di anointing can be quenched with just a distraction. That na why I command you to be in private, Elisabeth [Elisheva], with a very small distractions as possible. Becos you stay highly anointed and any distraction can quench am. I allow dis to happen while MY daughter dey speak di words from ME just to show you how easily [you] can be distracted and no hear any longer from ME.

TOTAL DESTRUCTION DEY COME!!!

Just warn di people say Destrution dey come.
Serious Warning From YAHUSHUA: “You dey hear from ME to help dis Ministry and you dey ignore wetin I tell you to do?” Whatever they are going to do for ME, whatever dem don promise to do for ME, I don put am for their heart to help dis ministry? Dem don ignore am? just to make excuse say, “Oh tomorrow or maybe another day. I go just come and I go just read, I no go even contact dem.” Dis people have gifts and yet dem choose to not share becos dem say, “Oh on another day.” But I tell you dis, and I dey speak dis forth.

TOTAL DESTRUCTION DEY COME!!!

And whatever dem don do for ME, whatever dem done do in MY Son’s Name; however dem don help di Good News to be preached, dis na di ones wey I go hear their cry. Whatever sacrifices dem don make, I go take notice on that day. I go take notice which ones cover their ears. I go take notice which ones cover their eyes. I go take notice when dem see you go in lack, and even when I put am for their heart, say make dem join hands and become faithful with di ones wey dey spread MY good seed into di harvest field, and dem shake their head and deny and say, “Oh no, no be me HE  dey talk. I warn dem now, I go take notice. Becos I send her forth as an Elijah of Old(for Hebrew mean Eliyahu). I send her forth to di widows of Zarephath, even though dem no know am. I go take notice on that day destruction dey come.

Dem help to feed MY Prophets? Dem offer water? Dem offer encouraging word? Dem offer shelter? I ask prophets of old again and again for Bible and I always go send dem with MY message and it was always their choice whether di people go hear or whether dem go respond in godly fear or dem go chase di prophets away? Nothing don change dis very day.
So tell dem, MY Daughter, tell dem for ME so that dem no go say dem no warn dem.

TOTAL DESTRUCTION DEY COME!!!

Are they ready? Ask dem say wetin dem done do for ME?
End of Prophecy

* * * * * * *

Prophecy 55 – Dream

YAHUSHUA! We Are Your Bride! We dey Wait For You!

Urgent, dis na recent dream wey only prayers go fit prevent from happening, interpretations of di dream dey for di bottom of page. Please help me sound di trumpet of warning. If your pastors no go listen, then you dey in di responsibility to speak am out anyway. I feel di strong importance for my spirit. I receive dis clear dream on Dec. 19, 2001. Di only reason why I share am with you  no be to cause fear, but instead to ask for your prayers say dis dream no go come to pass. YAHUVEH dey speak to us thru visions for dreams and revelations also prophetically. Only di fervent prayers of di righteous go stop dis dream from becoming a nightmare. Please share am with others, and ask your church to get down on their faces and repent and ask for mercy on America once again. If di churches or pastors refuse, then make you start prayer groups and intercede.

Dis dey very Urgent. I dey live for America. Why I no go care? Is this America wey I dey see? Di country will be hit twice when dem no go even expect. We get powerful military protection but only YAHUVEH go dey able to stop or hinder wetin di devil wants to do and na only di fervent prayers of di righteous people go prevent or stop dis! We must care. How many non saved people do you know?

Dream with Starving Baby

As I dey stand outside looking at a beautiful blue sky, everything just dey peaceful. As I look up I see 4 circles in di sky as di finger of God YAHUVEH dey draw dem slowly. After HE draw di 4th circle, I hear dis loud roaring noise, I go inside di house, di HUGE wind come destroying and killing e be like di after effect of a nuclear blast from nuclear bomb! I watched for horror as di death and destruction happen. Inside my house I see dis woman wey carry dis  tiny baby. I looked at dis baby and di baby be like say e don die and so undernourished. I say, “Why you no feed dis baby?” She look at me with dis cold look come say “Becos di baby dey fast.”

Then before I try to take di baby from her hand, she open di window and throw di baby out of di 2nd story window. I run outside for inside di radiation and di destroying wind, and catch di baby for my hand, and di baby start to breath again! As I stand there dis man dey come towards me his face was burnt so badly from radiation, and him face was red with 3rd degree burns, he no even say a word, he just waka past me. I go back into my house, fully protected from radiation, and I know say nothing go fit harm me along with di baby and fed di baby milk from feeding bottle.

After a while di destroying winds stop. Everything appear peaceful. I then look at di sky again, and I see di first circle start again, I start to shout Repent and turn your hearts to YAHUSHUA becos again judgment don come. Na very few people listen! I see di other 3 circles all of dem in a row, 4 of dem, and then di sound of a roar wey I no go fit describe. Then di destroying wind come again, as if another nuclear blast just happen. I discern di woman as religion, and di baby na di congregations, di organized religion dey starve di people by forcing dem to fast for more spiritual knowledge and prophetic truths and revelations. I am used to feed di people wey dey starve in their own churches, di pastors dey sacrifice di people for di sake of feeding demsef with wealth, control, and thinking say na dem di sheep belong to, forgetting say that there is only one Good Shepherd.

Please warn everyone. YAHUVEH speak to me for dream and warn me why HIM go remove HIS hedge of protection again, even di heathen dey worship a heathen god, and who America dey worship?

For November I have dis similar dream.

As I dey waka down di road and dis cow wey dey filled with milk come dey follow me wherever I go. But no be my cow. Di farmer accuse me say I dey steal his cow. I say I no go fit stop di cow from following me; na di cow choice. I see 3 squares in a row wey di finger of YAHUVEH draw in di sky. I hear dis sound like a roaring noise. Wey I no fit to explain. Then I see as I dey for di mountains and huge rocks dey come to my direction. I run to di ocean where my home dey for di dream. I enter di house. Then I come see di 3 squares again as YAH draw am for di sky. I watch in horror, and try to think of di way wey dey less painful to die, as I think say di ocean go cover di house and swallow everything if I remain there so I decide to go to di mountains again. I hear that roaring noise and then right after  YAH draw di 3rd square like I  I see before I go even move dis fireworks for  sky, di first light color na di boring kind, then brightly colored fireworks. It was beautiful fireworks. I no run, I just watch di fireworks.

Please send me your discernment on di dreams. I know say di cow na di people filled with milk from other pastors teachings, but dem no want any more. Only di fervent prayers of di righteous go mean very much, if my people go fall on their faces and humble demsef, I go hear their prayers and heal their land! Please take dis dreams seriously. YAHUVEH speak to me with voice 3 years ago and 2003 go be di 4th year. He say, “In four seasons you go know.” If we discern correctly, di 4 seasons na years.  Do we really have that long or di end dey come very soon? Becos too many people get di desire to destroy America and have di power and only YAHUVEH and YAHUSHUA go fit stop dem. He go use our prayers. Who go help us intercede? We must have more time to reach dis world for di kingdom of Heaven.
Di one good thing na I am protected. Also you also if you dey under di wings of YAHUVEH as  Psalm 91 take talk, di secret place of di Most High God. Is anything too hard for God? Di 3 Hebrew children dem throw dem into fiery furnace  wey dem heat up 7 times hotter and nothing for their body burn but di ropes wey dem use to tie their hands and feet. God YAHUVEH can keep us from harm during dis time also.

Please tell others about di saving grace of YAHUSHUA so that they will be saved. No fear wetin man wey can only destroy di flesh, but instead work out your own salvation with fear and trembling with YAHUVEH WHO can  kill your flesh and throw your spirit into di Lake of Fire. Because I love you, I dey warn you. Ezek 3:17-21 di blood  no dey for my hands. Please remember di true Sabbath day and keep am Holy. Keeping di Sabbath does not mean legalism, beware of legalism and bondage, dis na blessing and a rest unto di children of YAHUVEH. As in di times of Moses there will be blessings of protection for di people wey dey keep di True Sabbath becos of love of YAHUVEH and YAHUSHUA. Dis instructions were given to us with Adam and Eve, and di Bible say di Sabbath na something wey no dey stop and no go ever change. Catholicism nain change di true Sabbath; every day worship YAH but especially draw close on di true Sabbath. YAHUSHUA come to fulfill di Law of Moses, HE no come to cancel am. Di house wey I run into na my ARK of safety. Be sure say you dey inside di Ark, when dis go happen under di shelter of Psalm 91. Remember call upon di name of YAHUVEH and YAHUSHUA. There is power in di Sacred Names.

Love and Blessings in di awesome NAMES of YAHUVEH and YAHUSHUA. Apostle Elisabeth Elijah (Elisheva Eliyahu)

* * * * * * *

First Interpretation:

Dear Sherrie (Elisheva Sherrie),
I dey pray about di dream. I believe it is clear say di Lord dey show you di harlot and she no dey willing to feed her child di meat of di Lord. Therefore di Lord don determine a judgment upon her. Three times di Lord don speak to her. Judgments don start to come and e start with di Harlot. She be di great harlot wey Bible talk about di one wey dey ride di beast. GOD don speak to her countless times and na time to come out of her my people and for you to not be partakers of her sins. Why do you continue to go to houses of harlots and only want spiritual milk wey cannot make you grow to maturity?

And now di Lord don send leanness to your souls and you still fail to come out of her my people. And why? So that you go have nice friends and nice homes and nice cars and nice places to worship? Why should you have all of these things and yet you forget me days without end. Di Lord wey love you and save you and nourish you and you go after di prostitute and di harlot? And how she go fit take nourish you oh ye foolish people wey forget me days without number? Why be say you dey go seek di Harlot and her outward beautiful appearance instead of di Lord?

Therefore becos you dey go seek di prostitute church and you no seek me and you have not obeyed MY voice wey warn you to come out of di prostitute church, I no go listen when I send MY judgments against her. Dis things wey you no supposed to partake in. But you tell yourself, say “whether any other way dey available? di way of di prostitute no be hin be di only way I can go? Church buildings no dey for every corner and I no go fit get di spiritual meat for there?” But you say to yoursef, “So what? At least I have a place to stay at di side of di road where dem fit feed me and nourish me and I can have wealth and prosperity too!”
And di prostitute wooed and cooed and pull you in and you eat di bread in di fancy places and you find a little peace and comfort. But I say “Dis people no go listen to me, I have to send a stronger call or else she go enjoy di prostitute too much and she rocks my people to sleep”. But when di destruction come I say, “Look now and see, she go repent, di people go see their need of ME? Dem go repent for living for demsef and for dis houses wey dem build in my name? Oh dem go hear now wey dem see say their houses built in my name no go fit save dem, no go fit protect dem? Will a house of cement and block protect you my beloved? Will di people, di priests wey dey sell you my name and my host dem go help you when I command judgment upon di prostitute church? Will she go come to your funeral? Will she prepare your deathbed for you? Will she sing at your burial? I say not!”

Becos I go judge her says di Lord and when di judgment come everything wey dey offend shall be burn down with fire. Every last hymns song in which you trusted in. Every last church building and bell and instrument of music all of dem shall be destroyed. And why you ask? E no dey enough to worship on Sunday and meet on Wed. and pay di tithe and di offering and give to di local church? I no pay my dues to di Lord when I pray? But you no know me. You no gree know me. You no gree spend di time to know di one wey save you. You spent your days living in vanity and di useless things wey fill your mind and you forget di one wey love you and died for you.
And now I no go fit endure with you anymore. Di days are here for you to know di one wey died for you is true. If you repent and turn from your sins and bow to me and follow me you shall be saved. But I go judge di great prostitute MYSELF and everybody wey go still dey inside her on that day would be damned. Sherrie (Elisheva Sherrie), E no dey hidden from me wetin di Lord go do. I don come out of di prostitute Church for years.

Sherrie (Elisheva Sherrie), E no dey hidden from me wetin di Lord go do. I don come out of di prostitute Church for years di great prostitute na di false religious system wey dey sell Jesus on di street corners and for inside di greatest buildings built on earth. Dem dey sell Jesus for dollars and feed di children bread, when dem supposed to feed dem more. But dem want di wealth of di dollars from di people so dem go feed di children milk and di milk don even get weaker as di greed dey  increases. Even though di pastors, many of dem have di meat or di most important matters of di word inside dem and in their hearts dem no gree share am for dis reason. Dem dey fear to offend di people dem  no want to loose di people wey dey follow dem and loose di money to support di buildings and programs and things like that.

Well that na great sin and a great bad smell in di nose of GOD. How it should be di exception na di true Apostles and Prophets dey work to support demsef with only few wey dey follow dem while di false workers of di Apostate church dey line their pockets with di wealth of di children. And was it not so in di time of Jesus first appearing? They were buying and selling doves in di temple. Now dem dey sell tapes, and books, and statues, and trinkets, and coffee, and food, and all manner of things and including taking di tithe and offering. GOD no go judge dis kind of church? Can God allow dis evil to continue? No and a thousand times no!!! Now di anger of di LORD don kindle against di false and he go vomit di prostitute church out of HIS mouth.

HE still dey call di true bride to come out of di false prostitute church. That means if you be part of any denomination, come out. Lutheran, come out. Methodist come out. Presbyterian come out. Come out of everything wey dey exalt itself above di LORD and di true church. Becos her sins don reach as high as to di heaven and di LORD don remember her sins. And GOD greatly greatly judge dis Whore wey dey sit as a queen and think say she no go ever see sorrow. How dare she exalt herself greatly like that. Who she think say she be that she dey spout and spit and declare herself to be queen and say she no go be a widow! Come out of her my people. You be catholic? Come out! Come out! Come out! Yes di trumpet dey sounding can you hear it? Di days don almost dey end. You no go fit change di prostitute church. Di prostitute church go change you!

No one go fit change di prostitute church. If to say e dey  possible di LORD for don change her. But now she dey line herself with di wealth of my undernourished children and she no feed MY Children di wealth and revelation of my word but don commit di sins of Judas wey sell me for thirty silver coins. Make di person wey get ear hear wetin di spirit dey tell di churches. Today na di day to hear. No harden your heart as in di day of provocation when di children of Israel fall in di wilderness becos they were not satisfied with di true bread from heaven. Come out. Come out Come out!!!! Thus saith di Lord.

* * * * * * *

Additional Interpretation:
My interpretations of dreams happen to be very simple I hope others go dey able to discern a deeper meaning if there is one. Devastation go come quickly, from out of di blue, e go take everyone (except those wey dey plan am) completely by surprise. Di 4 circles refers back to di following, posted on dis website: Sherrie Elijah (Elisheva Eliyahu) wake up as Father YAHUVEH dey speak on Oct.16 1999 approx. 7:00 am central time…”In four seasons you go know, gift of healing sound of trumpet!” Di 4 circles refer to dis Four Seasons [Summer, Spring, Winter, Fall?]. YAH first show Elisabeth (Elisheva) di completion or end of di 4th season and wetin go happen at that time. As she see am again di second time confirms say dis na sure prophecy from YAHUVEH wey go come to pass, also that there will be two waves of destruction. Di sound of di trumpet (shofar) go call di Bride of YAHUSHUA home to safety -before di destruction go come – to di Marriage Supper of di Lamb.

Even as dis storm dey race across our country, di reprobate churches go continue to dupe their congregations while dem dey starve dem spiritually. Di woman na that church, wey dey throw her starving congregation from a 2nd story window. Elisabeth (Elisheva), represent those wey dey teach di truth and wey dey nourish those wey turn to dem for help, dey feed di starving baby. She and di baby dey fully protected from di radiation wey dey her house becos of her faithfulness and obedience to di calling of YAHUSHUA.