Prophecy 72, Planet X


Prophecy 72
Planet X

Given to Apostle Elisabeth Elijah (Elisheva Eliyahu)
July 12, 2003

Dis na from Prophecy 105, YAHUVEH say to put dis up for all Prophecies from now on: I warn you a long time ago Elisabeth [Elisheva], make you no call dis Ministry after a man or a woman name.
Even before dis Ministry start, I put am for your spirit. Becos nothing wey dey here come from your hand.Nothing wey dey here commot from your mouth. Na from di Mouth of YAHUVEH dis take come out. Na from di Mouth of YAHUSHUA, your MASHIACH, na dis take come out.
Na from di Mouth of di RUACH HA KODESH, your IMMAYAH, na dis take come out. If to say na by your hand e for don fail long time ago. Na by di SHKHINYAH GLORY Wind
wey dey blow across dis earth, di HOLY Wind of Revival. No be by your breath, or e for don fail. Isaiah 42:8

For July 2010, YAHUVEH GOD also say to add di following as a warning to those wey dey mock:
But dem mock di Messengers of GOD, despised HIS Words,
and no take HIS Prophets serious, until di Wrath of YAHUVEH
arise against HIS People, till there was no remedy.

2 Chronicles 36:16

* * * * * * *

[Planet wey go cause Mass Destruction Prophetic Warning. Is dis di Planet X wey so many people dey warn about? I no know if na him or not and I no know di scientific data, but I do know wetin YAHUVEH tell me and di anointing hit me as I write di message wey dey down.]

PROPHECY 72


Foolish man to think say you can use mathematics to calculate di date wey ME, YAHUVEH go use a planet in MY great anger to cause mass destruction to MY enemies. A word of prophetic warning to di rich and powerful wey think say dem go be safe for their underground cities full of your treasures wey you store up, delicacies of food, and everything else. Di underground cities wey you build and still dey build go be your watery burial ground and you shall die with your treasures of earth and ME, YAHUVEH, don delay that judgment becos di prayers of di true believers in YAHUSHUA’s Name, those wey dey obedient, wey dey walk Holy before ME will be protected and I don have mercy so far for di sake of MY Children wey dey call out for more time to reach more souls for di Kingdom of Heaven.

Judgment is delayed but e no stop and na ME, YAHUVEH, alone wey go calculate di date when MY Great Anger go hit di earth. ME, YAHUVEH, don delay di judgment to confuse and shame those wey build di underground cities wey dey think only of demsef, proving say na ME, YAHUVEH, alone be Judge over who go live and who go die and who go enter Heaven and who go go to hell.
Remember say ME, YAHUVEH, send out MY Apostles and Prophets to warn before I send MY Judgment. Na your choice whether you go listen and obey but know dis, everybody shall reap wetin dem don sow whether na good seed or bad seed.”

END OF PROPHETIC WARNING

Given to Elisabeth Elijah (Elisheva Eliyahu), July 12, 2003