Prophecy 53, I DON GIVE YOU DI VICTORY


Prophecy 53
“I DON GIVE YOU DI VICTORY!”

Na under di anointing nain
Rev. Apostle Elisabeth Sherrie Elijah (Elisheva Eliyahu) take speak dis prophecy and na so dem take write am for here
NEWEST PASSOVER PROPHECY
March 28, 2002

(Dis na from Prophecy 105, YAHUVEH say to put dis up for all Prophecies from now on: I warn you a long time ago Elisabeth [Elisheva], make you no call dis Ministry after a man or a woman name.
Even before dis Ministry start, I put am for your spirit. Becos nothing wey dey here come from your hand.Nothing wey dey here commot from your mouth. Na from di Mouth of YAHUVEH dis take come out. Na from di Mouth of YAHUSHUA, your MASHIACH, na dis take come out.
Na from di Mouth of di RUACH HA KODESH, your IMMAYAH, na dis take come out. If to say na by your hand e for don fail long time ago. Na by di SHKHINYAH GLORY Wind
wey dey blow across dis earth, di HOLY Wind of Revival. No be by your breath, or e for don fail. ( Isaiah 42:8)

For July 2010, YAHUVEH GOD also say to add di following as a warning to those wey dey mock:
But dem mock di Messengers of GOD, despised HIS Words,
and no take HIS Prophets serious, until di Wrath of YAHUVEH
arise against HIS People, till there was no remedy.
      —2 Chronicles 36:16

Prophecy Begins


Truly MY Children you dey face di Red Sea. Truly MY Children di evil Pharaoh and troops dey behind you, but MY Children just as I take provide a way of escape for Moses and di children of Israel, na so too I go do am again. MY Children, in di coming days wey dey ahead, you go see things come upon dis world wey go make you shake your head and you go wonder and you go say, “Where is our YAHUVEH and YAHUSHUA today?”

But keep your faith and keep your eyes on ME and you go see di Red Sea divide once again and you shall cross over in safety and di enemies shall be destroyed. All those wey dey pursue you, all those wey dey chase you, they shall be destroyed. For I AM YAHUVEH and I no dey  change. I AM YAHUVEH, and I AM di same yesterday, today, and forever. And through MY Son YAHUSHUA Blood, make you boldly come before di Throne and make you boldly tell ME wetin you need.

I tell you dis day, I don give you di victory. I tell you dis day, though Elisabeth [Elisheva] was meant to be dead, I tell you dis day say nothing wey di enemy plan to do wey I go allow to be done. I tell you, I don give you di victory, though [fighting] for hours with di sword of My Spirit for your hand, that door once again don open.

Once again, MY Children, you see di victory. It was not a easy victory. I never promised you say e go be a easy victory. When I tell you say e go be victory, just remember that no one ever tell you say e go dey easy. Na true say MY yoke is easy and MY burden is light, but MY Children there is a price to pay for di anointing wey I don put on all of una life.

So make you eat dis Passover feast, you no murmur or complain becos instead you do am with a grateful heart and remember wetin happen with di children of Israel. Remember di children of Israel wey wander for 40 years. E for no take dem that long if to say dem no murmur, complain and grumble. But I make dem walk around and around, as some people dey call am, in circles. I make dem walk around and around and test dem again and again.

I tell you MY Children, I tell you dis true, make you no murmur, no complain, no grumble, no matter wetin I allow to happen to you. Instead lift your eyes up to ME. Instead give YAHUVEH and YAHUSHUA di glory. And know say I alone I be your deliverer. And know say alone thru di shed Blood of MY Son YAHUSHUA, say you have di victory. Thru di sacred Name of YAHUSHUA, you alone have di victory. I don  promise you dis if you go just obey. If you go put your ear to everything I say, I tell you MY children dis, you go have di victory. Remember, with a victory also comes a price wey you go pay. Remember, say no soldier wey go into a battle wey no dey feel tire. There is no soldier wey at one time been no want to run.

But remember MY Children, remember dis say I don promise you di victory if you go just obey, if you go just put your ear to every word wey I say, if you go just stay in holiness and live as an example for everybody to see. I tell you dis, MY Children, you and dis ministry go see total victory. You go see your enemies die by MY hand alone. You go see your enemies run by MY hand alone. You go see your enemies bow and kneel and confess YAHUSHUA as Lord and Savior. And e go only be as I don decree di victory in MY Son YAHUSHUA’s Name. And you go know say whatever price wey you pay go dey worth it, becos I don give you di privilege to bring ME Glory thru your sufferings. Just as di prophets of old, when people see you stand, dem go know say na only by MY Hand wey dey protect you and guide you in every ways.

MY Children, enjoy dis Passover feast wey I don provide for you dis day. Thank you for obeying ME, thank you for listening. For di blessing of dis Passover prophecy na also for other people and not only for you. Tell dem if dem mis doing di Passover Seder, even in a humble way, as long as dem acknowledge ME, say I AM di same YAHUVEH wey deliver di children of Israel from di Egyptians and from di curses and di plagues wey come. Tell them if only MY Children go do am in a humble way and acknowledge ME, no matter wetin di calendar day be, where their Passover is, na where their faith go be and where their faith is, na there their Passover go dey.