Prophecy 61, Where All Of My Holy Men Wey Dey Lift Up Their Holy Hands To ME, YAHUVEH


Prophecy 61
Where All Of My Holy Men Wey Dey Lift Up Their Holy Hands To ME, YAHUVEH?

September 11, 2002, 11:45 a.m.
Given to Apostle Elisabeth Elijah (Elisheva Eliyahu)

(Dis na from Prophecy 105, YAHUVEH say to put dis up for all Prophecies from now on: I warn you a long time ago Elisabeth [Elisheva], make you no call dis Ministry after a man or a woman name.
Even before dis Ministry start, I put am for your spirit. Becos nothing wey dey here come from your hand.Nothing wey dey here commot from your mouth. Na from di Mouth of YAHUVEH dis take come out. Na from di Mouth of YAHUSHUA, your MASHIACH, na dis take come out.
Na from di Mouth of di RUACH HA KODESH, your IMMAYAH, na dis take come out. If to say na by your hand e for don fail long time ago. Na by di SHKHINYAH GLORY Wind
wey dey blow across dis earth, di HOLY Wind of Revival. No be by your breath, or e for don fail. ( Isaiah 42:8)

For July 2010, YAHUVEH GOD also say to add di following as a warning to those wey dey mock:
But dem mock di Messengers of GOD, despised HIS Words,
and no take HIS Prophets serious, until di Wrath of YAHUVEH
arise against HIS People, till there was no remedy.
 —2 Chronicles 36:16

* * * * * * *

I am awake, As I dey wake up on September 11th. FATHER YAH been done already dey speak to me as I dey sleep. HE wake me up with dis words, and now, right now, even while in di middle of sleep my eyes still dey close, I go intercede now for dis country on September 11th. I go speak forth di words wey HE want me to say. [She start to speak as with interpretation in tongues.]

Prophecy Begins


Elisabeth [Elisheva], I give you dis responsibility to speak forth dis words now. That dis ministry is going to speak forth dis warning now. Even as Elisabeth [Elisheva] dey sleep, I speak to her to tell her wetin to say, even as her body now still dey desire to sleep on. Even as her eyes still dey closed, I dey speak forth dis words. Na September 11, 2002. And as I look over mankind to see wetin dem done do with di time wey I don give dem, di extra time wey I don give earth, wetin is it that I see? What is it that MY Eyes dey see? Becos I answer di prayers of di righteous ones wey dey call out in MY Name, in di Name of YAHUSHUA ha MASHIACH, MY Son. Dem dey call out to ME and say, “Give us more time to reach di lost souls” and so I don do as dem ask.

Dis na wetin MY eyes behold. Man dey sleep with man, woman dey sleep with woman, babies dem dey murder for inside belle, people stubbornly continue to be more evil each day. E no dey any different than for di time of Noah when I destroy di earth. But I spare di righteous ones, di obedient ones, Noah and his family. So again I say and I warn. I go only spare di righteous ones. September 11, 2001, all over dis world people dey talk about am, but na only about di tragedy, only of di destruction. Na very few people give ME di Glory, becos I save lives wey no even deserve saving. But instead of remembering dis day to bring ME Glory for di miracles wey I don do, instead I hear as dem dey slander MY Name, as dem dey ask “How could God have done dis?”

Even MY own preachers wey dey preach MY Word dey speak as though I no get di right to bring judgment to dis earth. I AM di Creator. You forget say you are di created ones, and so dis day I dey sorrow as I hear dis again and again. You forget who be di judge of all creation? Since when be say di created ones dey judge di Creator? I look at di word ‘marriage’. I see wetin e represent to you. I created Adam and Eve. Then why di same sex dey marry? Everything wey I say na abomination, why be say dis earth now dey lift those things up? As if in pride dem dey take di sins of dis earth and fling am for MY face and now dem dare say, “We be di creators, we go create a new human race.”
Where all of MY Holy men wey dey lift up their holy hands to ME? Why dem no be di spiritual head of di households? Why be say na di wives dey rule di marriages? Why di men dey tremble for corner? Again I don raise up di Deborahs around dis world to do di jobs wey di men supposed to dey do. Na di women know MY Word, no be all, but in so many cases na di women dey say, “Dis na di true Sabbath day, we go honor am.” Na di women dey take di children and raise dem up spiritually and then you dey wonder why a home wey dey divided go fall. You wonder why young people crimes dey rise, you wonder why your schools na place wey even di  most hardened criminal go fear. You wonder why di children dey rule di parents. Na becos MY voice you no gree to hear. MY voice you no gree to hear.

MY Good Book dem dey call am just another book. Dem say di laws is outdated. I observe today, wetin MY Children dey do with di new knowledge wey dem been no get before. Becos you I go hold you responsible for wetin you know. If you did not know say dis Holy Feasts na Holy Days unto ME, then I no hold you responsible. But I dey show you now di high Holy Days, how di Holy Feast Days were good enough for MY Son YAHUSHUA to observe. How much more should you observe dem.

MY Son YAHUSHUA na di LORD of di Sabbath, di LORD of di Sabbath, even when you know di correct day, how many of una still dey fill di churches on a Sunday? You preachers I go hold una responsible, again and again I don say, “You dey honor man Sabbath and cast away MY true Sabbath.” E dey good enough for di Creator, but di created think say dem have a better way.

So on dis day of September 11, I look on earth and if to say e no be for di prayers of di righteous wey dey really profit much, destruction for come to earth dis day. But instead I give you more time, although I hear MY true children say, “Oh come YAHUSHUA, come quickly today.” Dis earth dey bend towards hell, even di earth dey quake and shake in fear, becos di earth knows say di judge of all creation go judge dis earth and go quickly appear. Your waters dey polluted becos of man-made sin, you wipe out different kinds of animals just becos you want to murder or you want to wipe out their habitat for your own foolish purposes. But I don preserve each type of animal in Heaven, different kind wey no longer dey for dis earth and MY Children wey their home go be in Heaven, dey assured, say dis different kind of animals are saved for you.

I love you MY beloved children, those wey now no dey afraid to do everything wey I say, those wey dey respect di Holy Days, those wey dey cry out and desire for YAHUSHUA to come. Dem dey cry like di five (5) wise virgins. Dem get di oil for inside their lamps as dem dey wait and dem even get extra oil becos dem no know which hour or which day. Dem know say HE [YAHUSHUA] go return on a Shabbat, but which Shabbat? I don tell dis Woman Servant say, e go be on a Rosh Hashanah and one (1) coming shall be, but which Rosh Hashanah?
MY Word says HE go come in di midnight hour but which midnight hour? So as MY beloved ones dey  try to calculate which hour MY Son go come, MY dear ones, dis na foolishness. Instead just work for ME and occupy, keep your lamps on, work to bring di only treasure wey you can when you leave earth. becos nobody go know, as thief take dey appear in di night, na so di love of your life. But will HE find you without spot or wrinkle?

For wives, you represent di Bride, husbands you represent di Bridegroom. Dis na how you go know if you are pleasing unto ME. Di wives wey get godly husbands, wey dey cry out in YAHUSHUA’s Name wey dey do all they can do to obey ME and MY Word. I ask you dis, “Are you doing all you can do to obey that godly man?” I ask dis to di husbands wey represent di Bridegroom, “Are you doing all you can do to love and protect her, to be di head and not di tail? Do you deserve their respect that she go desire to obey you di way di Bride of YAHUSHUA supposed to dey obey HIM? Are you praying with your family? Are you on your knees with your wife? You dey hold her hand when you pray? You dey bless your children? You dey observe MY Holy Days? Are you honoring ME on di true Sabbath, or you just dey do your own pleasure and your own way? You be example of di godliness?”

Dis na questions wey I dey ask you dis day. You dey stand up for holiness and righteousness or are you browsing for porn for internet? You think say your sin dey hidden in secret even those wey dey stand behind pulpit? You dey worthy of respect of di word ‘husband,’ becos you stand for di Bridegroom wey dey come. MY Son dey rule with love and compassion. You think  say you go rule your house with nothing but savage force? Repent today, those wey dey call demsef husbands, for so many of una no dey worthy of your wives’ respect. But for those husbands wey dey reflect di soon coming Bridegroom, you dey worthy of that respect and you must demand that your household respect everything wey you stand for. And dem go love and dem go honor you and dem go desire to obey just as surely as di Bride of YAHUSHUA dey desire to obey.

So instead, on dis September 11th, of accusing your Creator or listening to those wey dey accuse your Creator, hang your heads in shame, becos di created ones wey I formed from dust, just a piece of sand for MY hand, and I breath into am and created man, no get di right nor di place to judge di Almighty God YAHUVEH, di Creator. Judgment go rain down again. Judgment don already begin. First e begin at di House of di Lord, those wey who are called by YAHUSHUA’s Name, and if I no allow MY own house to go without punishment, how much more wey I go judge di heathen for di bad smell of their sins.

So I don speak dis day to dis Woman Servant, and she don obey ME and now she give you dis words on September 11th, 2002, na so I speak am, na so dem go write am. How many of una go allow ME to get your garments spotless and white before I send MY Son. Which Bride go stand for her wedding gown covered in stains and spots? Ask yoursef dis questions when you beg MY Son to come. I go find you ready? Your wedding gown dey pure and clean? Is there enough oil inside your lamp to continue to wait for HIM [YAHUSHUA]? Or will you be like di five (5) weeping and wailing foolish virgins wey run out of oil for their lamps, wey tire to wait? Be ready now MY Children, becos di midnight hour is late.

Na under di anointing of di RUACH Ha KODESH, nain dis prophecy to come forth and nain dem take write am down on September 11, 2002, starting at 11:45 a.m. and ending at 12:13 p.m.

I deliver dis as I take receive am and I humbly submit am to you, and I just pray say those wey get ears go listen.

Apostle Elisabeth Elijah (Elisheva Eliyahu)