Prophecy 62, DI KING IS COMING REPENT! REPENT! REPENT!


REPENT! REPENT! REPENT!
Prophecy 62
DI KING IS COMING!

Na under di anointing of di RUACH ha KODESH
YAH speak thru Apostle Elisabeth Elijah (Elisheva Eliyahu)
on Yom Kippur, September 16, 2002
(Dis na from Prophecy 105, YAHUVEH say to put dis up for all Prophecies from now on: I warn you a long time ago Elisabeth [Elisheva], make you no call dis Ministry after a man or a woman name.
Even before dis Ministry start, I put am for your spirit. Becos nothing wey dey here come from your hand.Nothing wey dey here commot from your mouth. Na from di Mouth of YAHUVEH dis take come out. Na from di Mouth of YAHUSHUA, your MASHIACH, na dis take come out.
Na from di Mouth of di RUACH HA KODESH, your IMMAYAH, na dis take come out. If to say na by your hand e for don fail long time ago. Na by di SHKHINYAH GLORY Wind
wey dey blow across dis earth, di HOLY Wind of Revival. No be by your breath, or e for don fail. ( Isaiah 42:8)

For July 2010, YAHUVEH GOD also say to add di following as a warning to those wey dey mock:
But dem mock di Messengers of GOD, despised HIS Words,
and no take HIS Prophets serious, until di Wrath of YAHUVEH
arise against HIS People, till there was no remedy.
 —2 Chronicles 36:16

* * * * * * *

Elisheva Prays
Elisabeth [Elisheva]:
So Heavenly Father YAHUVEH, in di Name of Your Son YAHUSHUA on dis Yom Kippur, I ask wetin e be wey YOU want to say? We come to you, we dey seek to hear your voice, if you go honor us please with a word. We be like deer wey dey  very thirsty for water, FATHER; we dey thirst to hear from you more. We just thank You, FATHER. We rebuke and we bind you Satan away from dis in di Name of YAHUSHUA ha MASHIACH, you no get any part in dis whatsoever, for we belong to YAHUVEH, YAHUSHUA and di RUACH ha KODESH. You no get claim over us whatsoever. We submit oursef to di Lord God Almighty YAHUVEH, YAHUSHUA and di RUACH ha KODESH and we resist you satan and you must flee.

[She dey speak in Tongues] Luke 10:19, Satan, “Behold I give you di power to step on serpents and scorpions and over all di power of di enemy and nothing whatsoever go harm you. So, Satan, we stand on that Word. Get lost devil, you no get  any claim over us. Only di words wey go come forth, go be from YAHUVEH, YAHUSHUA and di RUACH ha KODESH. No false word go manifest thru my flesh, no false word go manifest thru a demon by manifesting thru my flesh, no false word go come forth, for in di name of YAHUSHUA, I only dey speak forth di words wey my Daddy God YAHUVEH, wey created me, go want me to speak, wey go glorify, magnify, di Name of and from YAHUVEH, YAHUSHUA and di RUACH ha KODESH.

Speak to your children, O Daddy, speak to your children if you have a word.

Prophecy Begins


Tell di people, shout am from one end of di earth to di other, MY SON IS COMING, di King of Kings and Lord of Lords. Tell dem, MY Children, repent di Kingdom of Heaven dey near, fall on your faces on dis Yom Kippur day. Fall on your faces in di Spiritual realm; see yoursef flat on your faces, becos di King is coming!
Make di world mock. Make di Pharisees mock. E no go stop becos di KING IS COMING! HE no dey come for those wey no think say dem be sinners, wey dey think say dem dey righteous, that dem no even need to repent. HE dey come for HIS Children, for di Bride wey dey desire to obey. HE dey come for di warriors wey dey war in HIS Holy Name. HE dey come for those wey dey humbly admit say everybody don fall short of MY glory.

Just be ready, MY Children. E no matter if you know di day or hour. Which Bride no know when her Bridegroom dey come? Which Bride no go prepare hersef in advance? MY true Bride dey hear MY voice. Dem dey prepare demsef. Dem dey desire and dem dey seek Holiness. Dem hate di yeast of di Pharisees.

Hide yoursef MY Children for just a little while. Becos all of Heaven dey war, and against satan and his demons war dey go on. It is waged, becos di King is coming! Di Earth dey quake and shake in fear for different parts of di world. You dey see floods, dis na MY tears. Remember when di floods come in di time of Noah. Remember how dem take laugh Noah and dem Laugh am up until di time di rain start to fall. But I tell MY Children Noah and his family to get into di ark and close di door, and when di floods come, di ungodly ones beat on that door. Then dem wanted to come in, na then dem believe who I AM, but it was too late for dem and di floods swallowed dem.

Na so e go be again. Those wey dey stand in MY Son’s righteousness, those  wey don anoint their homes, those wey dey hide in MY Word, those wey dey do their best to obey, those wey dey love and serve and put ME first, those wey know say di treasures of dis earth no go be wetin dem go fit take to their Heavenly home. In dis world dem realize say thieves dey break in. Moth and rust dey spoil that thing wey you think say na treasure on earth you no go fit take am with you when you leave dis earth.
Instead MY true Children, instead MY true Bride dey  build up their Heavenly treasures where moth and rust and thieves no go fit spoil. Thieves no go fit steal your treasures wey dey Heaven. So many dey go in lack, but dem dey do am for MY sake, dem dey forsake luxuries so that souls can be saved. Dis na MY beloved; Dis na MY true treasures on earth. Those wey dey cry out in MY Son’s Name, in di Name of YAHUSHUA and dey pray so many times a day dem no go fit even begin to count, Dis na MY Children, dis na di ones wey di King dey come for.

YAHUSHUA is on di way, di KING IS COMING! HE is your payment for sin. HE be di perfect Lamb that was sacrificed. No spot, no stain, no sin was found in HIM. HE paid for dis world, HE dey ransomed for dis world for all those wey go fit believe and receive di Blood that was shed at Calvary. HE pay di atonement for your sin. HE be your High Priest. For those Jews wey dey deny HIM, for di Muslims wey dey deny HIM. Dem dey acknowledge Abraham, Isaac and Jacob, but dem no accept HIM as MESSIAH, when e comes to di Name YAHUSHUA.
Then na by di laws of Moses they will be judged and dem better make sure say dem no brake one commandment. How many dey find am hard to obey ten. Try 613. Why you think say I give you a High Priest wey fit understand and pity you becos of your infirmities and weaknesses? Becos MY desire na make no one perish. But for those wey dey insist to be judged by Moses, then Moses go judge dem and woe unto those wey Moses go judged becos there is no mercy in him.

So in dis ten days of awe, rejoice for those wey know YAHUSHUA as Lord, rejoice say HE be your MESSIAH, your Deliverer, your Healer, di One wey I Bless you with when you call out to ME in HIS Name. Becos ME, YAHUVEH, I AM glorified thru MY Son YAHUSHUA and YAHUSHUA is glorified by HIS FATHER YAHUVEH. And I dey take great enjoyment in protecting MY Children and confusing di enemy in many different ways.

I tell dis Woman Servant dis day to warn you of di coming quarantine becos man dey make diseases wey I no create. Then man creates wetin dem call a vaccine. But beware MY Children, death dey for inside wetin dem go inject inside you. No trust in di inoculations of man. Trust in Psalm 91. Believe in MY Son’s Name, and call upon ME and make you stand on Psalm 91, say I go  keep away di plagues from your house. And as you honor ME on di true Sabbath day, as you try your best to obey, as you put ME first in your Love and your life, and as a husband take di rightful place over di wife, there will be a protection to come upon your house, for na di Blood of MY SON wey HIM shed  for you at Calvary that  will cover and protect you and those wey dey called by MY Name, those wey get godliness inside dem.

I go speak on dis more at another time, becos now no be di season. I warn you now, MY Children. Pray say you will not be counted in di number of di quarantined. For so many people dem go gather dem like animals into even stadiums and coliseums. And di evil ones go say, becos you refuse di protection of man, then you are contaminated, you are a danger. And like dem take dey  gather animals dem go gather so many into big crowd, room go hardly dey to even stand.

Beware MY Children of di poison wey dem dey inject into your veins. Beware MY Children of di very air wey you dey breathe. Beware MY Children of di very water wey you dey drink. Truly if to say no be for MY Mercy, life fordon erase off di face of di Earth. Beware MY Children of wetin you don inject for your body. Remember where your faith and your trust dey. Stand up for wetin dey right. Stand up for your freedoms now. Preachers, stop taking di bribes, becos dem don silence you far too long. I go hold you responsible for not warning MY sheep! And if you no speak up as dis Woman Servant dey do now, e go be like sheep wey dem dey leed to go slaughter.
First dem go start with di very young and then di elderly and then di middle aged go fall. But not any of MY Children wey on di Name of YAHUSHUA dey call if dem go jusy hear MY Voice and obey, and believe say I go protect dem and live Holy for ME as I AM Holy and run away even from di very thing that look like sin. I go protect dem. I go give dem wisdom. I go hide dem. MY angels go camp around about dem and war for dem.

For you have been ransomed, an atonement for your sins has been made. Dis na wetin you are to celebrate on Yom Kippur and YAHUSHUA na HIS Name. And so no longer dey ashamed to say di King is coming! But again I have to repeat, HE no dey come for a disobedient Bride, HE no dey come for disobedient children.

So repent now MY Children before e go too late. For a great evil dey come. E dey come with dis very big huge wave, a big huge wave of ungodliness. But look up, MY Children, becos I go raise up a standard against am if you can just believe and if MY Son’s love, forgiveness and mercy and Truth you receive. Repent, make dis be your cry to all far and wide for King YAHUSHUA is coming!

* * * * * * *

Elisabeth [Elisheva]:
Na so YAH take Speak am, nain dem take write am on September 16th, 2002 for Yom Kippur. E Started at 5:18 a.m. to 5:46 a.m. during private prayer time as we dey lift up di prayer needs of di partners. I apologize for di coughing wey you hear. Di satanic battle dey real. Di devil no want make di message come out, e just feel like say hands dey squeeze my throat as I start to say, “Di King is Coming!” We no dey  fight against flesh and blood, but there are rulers for dark places and satan and his demons no want di prophet to be speaking.

But however, I humbly submit dis word to you on Yom Kippur. I look forward to seeing you in Heaven.
In di love of YAHUSHUA, your, Apostle Elisabeth Elijah (Elisheva Eliyahu).

As YAHUSHUA done tell us already of di last days, “di heart of people shall fail dem becos of fear.” Luke 21:26
Are you spiritually ready? What about your family? Dis na di reason for dis ministry, to warn with di prophetic messages as well as to encourage and lead lost souls to YAHUSHUA, di only Messiah. If you don accept YAHUSHUA as your personal Savior, but you dey very lukewarm in your love, obedience and spiritual walk with Him, you need to immediately ask HIM for forgiveness and for a refilling of di RUACH Ha KODESH (Holy Spirit). You need to not only repent but turn away from your sins and to ask YAHUSHUA to wash your sins away in HIS shed Blood at Calvary. HE go instantly forgive you and fill your heart with di joy of di RUACH Ha KODESH.
If you never accept YAHUSHUA as Savior, but thru di Holy Bible and dis prophetic messages you come to realize HIS reality and say HE go soon come, and you want to accept HIS free gift of eternal life in Heaven, then make you say dis salvation prayer wey dey below and make you mean am with all your heart…and YAHUSHUA dey faithful to forgive you as you confess, repent and turn away from your sins, in YAHUSHUA’s Name. And ask HIM to come into your heart and live HIS (YAHUSHUA’s) life for inside you, and to use you for the Glory of YAHUVEH and YAHUSHUA.

Di Salvation Prayer

Dear YAHUSHUA, I accept you now as my Lord and Savior, You be di God wey I love. I believe say you don pay di price for my sins at Calvary, You die and rise up from di dead on di third day. I ask you to come into my heart, forgive me of my sins, wash me clean from all unrighteousness. I am sorry I don sin, and I turn away from those sins. Thank you for filling me with your RUACH Ha KODESH, and for giving me di desire to serve you all di days of my life, and make you live your life inside me, YAHUSHUA so that you will be Glorified! Thank you for giving me di desire to read your Bible, and give me di wisdom to understand am, Thank you for loving me and saving my soul, and for making my faith to grow, so that one day I go be with You in Heaven. Fill me with your Holy Spirit now and deliver me from di evil one in your name YAHUSHUA I pray. Help me YAHUSHUA to remember say everybody don sin and fall short of di Glory of YAHUVEH, and you come to save us sinners, that na why you are called our Savior. Amen.

Read dis prayer and then read am again, dis time no be with head knowledge but with heart knowledge, believe am in faith, and remember say YAHUSHUA no be only God, but HE be your best friend. HE care so much for you; HE loves you so much, just di way you are. HE hate Sin, but He loves you, di sinner.

YAHUSHUA don pay di price for your sins, now you no need to feel guilty or condemned anymore! Confess your sins to YAHUSHUA. Name dem, then tell HIM you are sorry, ask Him to forgive you of all your past and present sins. A sin na anything wey you don do or wey you dey do that displeases a Holy YAHUVEH. No one is perfect, remember that.

Read di New Testament and get to know who YAHUSHUA be. John 3:16. Di Bible say you must confess HIM as Lord and Savior so that HE go confess you before di Father. Make you no dey ashamed of YAHUSHUA, HE is not ashamed of you. Tell someone say you don accept YAHUSHUA of Calvary and Nazareth, dis day. All di angels for heaven dey rejoice. Make we also rejoice with you. If you need a pastor, we get more than one. Welcome to di Family of YAHUSHUA we dey look forward to meeting you in Heaven if no for here on earth.