Prophecy 64,Tell MY Children MAKE Dem Run Away from di Churches of Babylon!


Prophecy 64
“Tell MY Children MAKE Dem Run Away from di Churches of Babylon!”

Given to Apostle Elisabeth Elijah (Elisheva Eliyahu)
for October 16, 2002

Dis na from Prophecy 105, YAHUVEH say to put dis up for all Prophecies from now on: I warn you a long time ago Elisabeth [Elisheva], make you no call dis Ministry after a man or a woman name.
Even before dis Ministry start, I put am for your spirit. Becos nothing wey dey here come from your hand.Nothing wey dey here commot from your mouth. Na from di Mouth of YAHUVEH dis take come out. Na from di Mouth of YAHUSHUA, your MASHIACH, na dis take come out.
Na from di Mouth of di RUACH HA KODESH, your IMMAYAH, na dis take come out. If to say na by your hand e for don fail long time ago. Na by di SHKHINYAH GLORY Wind
wey dey blow across dis earth, di HOLY Wind of Revival. No be by your breath, or e for don fail. Isaiah 42:8

For July 2010, YAHUVEH GOD also say to add di following as a warning to those wey dey mock:
But dem mock di Messengers of GOD, despised HIS Words,
and no take HIS Prophets serious, until di Wrath of YAHUVEH
arise against HIS People, till there was no remedy.
2 Chronicles 36:16

* * * * * * *
 
Elisabeth (Elisheva) speaking:
E always dey suprise me who di RUACH ha KODESH go use to stir up di prophetic anointing wey dey inside me and when e go happen. Today I was told to call certain partners of dis ministry on telephone to see if dem need ministering too. I phoned di faithful partner of dis ministry and becos I obey dis new Prophecy come forth. I no go apologize for wetin YAHUSHUA speak thru me although I know say dis prophetic message go offend many but I pray say you go realize say I must do as Ezekiel 3:17-21 take warn.

I dey do dis because I fear to offend YAHUVEH and YAHUSHUA more than I fear to offend you. I dey do this becos I truly do love you and want to meet you in Heaven. Forgive me becos dis prophecy take  longer than normal but I no go fit control di RUACH ha KODESH. For those wey love me and dis ministry I ask you to please cover us in your prayers and fasting. Please email and let us know you are doing so. Dis prophetic message na for everybody especially for your Pastors. I also get di license to be pastor and if I no know di truths for inside dis message I  no go stone di person wey dey speak am out instead I go thank di person. It takes a humble Pastor to accept di fact say they were wrong and change Sunday Worship to Friday night or Saturday morning or afternoon.
As I dey telephone with a Sister in YAHUSHUA her name na Carol dis prophetic message come forth quite unexpected. YAHUVEH again dey call HIS people out of di Babylonian organized church system. YAHUSHUA no go come again until HIS children and Bride start obeying. Get out now oh mighty Warriors of YAHUSHUA. Judgment go start for di house of di LORD GOD YAHUVEH. Catholic Churches na part of di organized Babylonian system. Na di Catholic Church and Constantine create di man made Sabbath wey be Sunday. If you no think say e dey important then tell me so after you don listen to dis newest prophecy.
TELL MY Children TO RUN AWAY FROM DI CHURCHES OF BABYLON!

Given to Apostle Elisabeth Elijah (Elisheva Eliyahu)
Oct. 16, 2002

(Elisabeth [Elisheva] Prayer before prophecy) I plead di blood of YAHUSHUA over dis airwaves. I know say I was suppose to call Carol, FATHER becos I know now FATHER say you want to stir up di prophetic anointing inside me. Oh FATHER GOD YAHUVEH in di Name of YAHUSHUA ha MASHIACH. We just thank you and we praise you right now as we gather together in your name right now in di Name of YAHUSHUA . (She start to pray in heavenly tongues all di way thru out dis  prophecy She go speak in tongue then She go prophecy)
We rebuke and bind you satan right now away from us in di name of YAHUSHUA ha MASHIACH. I rebuke and bind every lying and deceiving spirit away from me right now in di Name of YAHUSHUA. I go only speak forth di words of YAHUVEH and YAHUSHUA my lips and my tongue dey covered in di name of YAHUSHUA ha MASHIACH. I bind my own tongue from speaking out any word of di flesh in di Name of YAHUSHUA ha MASHIACH. Carol I tell you di anointing is so strong on me right now I can barely even speak in English. Wetin you want to talk about Daddy? What is it?

Prophecy Begin


TELL MY Children TO RUN AWAY FROM DI CHURCHES OF BABYLON!

Tell dem MY Daughter, tell dem. Di majority of di churches na Babylon. Dem dey starve MY baby sheep and MY lambs. Di pastors dem be nothing but evil in all dis churches of Babylon wey dey speak forth MY Words and yet no get power for inside dem. No milk, no meat di only ones wey dey eat na di evil shepherds with di material gain of dis world to build on top their buildings wey dem already build. To compare di numbers with one another as dem take dey boast, I have dis many people for my congregation and I have that many for my congregation but oh how few of dem dey filled with MY SPIRIT. Oh MY heart dey in sorrow, MY Children!
TELL MY Children TO RUN AWAY FROM DI CHURCHES OF BABYLON!

Di ones wey get di man made Sabbath. Oh so few of dem belong to me  in MY churches. Dem say dem be MY churches and dem no even belong to ME. I don tell MY People MY true mighty warriors to run. Is not MY RUACH ha KODESH (HOLY SPIRIT) able to come into dem as dem sit in their own house? Truly I tell you dis di evil people don become more evil but MY anointing don grow stronger in di GODLY people. Becos demons have been release and where be di first place where dem go go? Dem fill di church sits and dem stand behind di altars, behind di pulpits. Dem stand there swell up in their pride. Dem say I have millions of people wey dey follow me. Dem dey boast of demsef for TV but I tell you di truth MY Spirit no dey inside dem.

Run children, run, run, run, becos MY judgment go start for di house of YAHUVEH. Di churches wey once belong to ME now I dey give di instructions to MY Children run. Oh di little ones dem dey go to dis churches just for a sip of di milk of MY Word. Dem no realize say behind di pulpit in so many of dis churches a man stand or a woman wey dey filled with satan spirit. Di youth pastors, di worship leaders oh how many dey full of satan’s spirit.

Oh I grieve and I cry for those wey once start to follow ME and worship YAHUSHUA ha MASHIACH, wey dey cry out to Jesus Christ, wey start out on di right road but when trouble come and testing come and dem need more of MY anointing dem turn to di organized church where MY anointing you no go find for there, for na di anointing dey break di yokes and bondages wey dey set di captives free. But instead dem turn to a organized church, dem turn instead to a religion, dem look for ME for dead places wey be like cemetery that na wetin I call dis seminaries dem be cemeteries. But MY mightiest warriors you no go find there and I send MY mightiest warriors to go after di little lambs and to lead dem to ME.

So MY Children warn dem. Get out there and go and get MY little lambs and warn MY sheep becos di evil pastors dem dey under MY wrath, those wey no want to preach di truth, and dey lead MY Sheep and Lambs astray, those wey no want to warn say ME,YAHUSHUA, your MESSIAH I no be only di GOD of love but a GOD of wrath. I was only a Lamb one time now I AM coming back as a lion from di tribe of Judah. As I take flog di money changers and as I overturned their tables na so I go do am again. But di churches no go remain standing; di Pastors no go remain alive for I AM  jealous for MY lambs and MY sheep.

Before di Crystal Cathedrals go come down, di ones wey dem build with silver and gold ME,YAHUSHUA, go chase di Sheep and di Lambs out those wey be MINE wey dey filled with MY RUACH ha KODESH I shall anoint dem for Mighty Warriors and dem go tear down di gates of Hell in di Name of YAHUSHUA. Dem go set di captives free in di Name of YAHUSHUA. Dem go do healings in di Name of YAHUSHUA.
There is only one Good Shepherd and any pastor wey make dem think say demsef na di only good shepherd, I say dis to dis evil shepherd wey try to control di people, wey dey tell dem do am MY way and not your way. I shall kill di evil shepherds. I shall tear down di houses wey ordinary hands make, dem make with di silver and gold wey dem use greed take store up. As di evil times are upon us, as di evil times are upon you and dis world. All dem dey do na to look for how to protect demsef, dem no think of providing for anyone else but demsef. But MY true shepherds, those wey I don give di anointing to protect di lambs and di sheep, wey get di anointing to lead dem to ME. Dem get di desire to provide to feed and to clothe MY Baby lambs and sheep.

Dem get di anointing to love and allow di love of YAHUSHUA to flow thru dem. Dem love enough to warn people of hell. Dem get enough love to warn people say I AM a GOD of balance. Dis na how you go know whether MY RUACH ha KODESH dey inside that shepherd. Dem no dey swell demsef up with pride. Dem no dey build multimillion dollar churches. You go discern whether or not MY RUACH ha KODESH dey inside dem.

But Oh how many of di so called churches, Oh how many of di so called Temples wey MY RUACH ha KODESH dem no even dey allow inside. No moving of di SPIRIT. Any true apostle and prophet dem go kick out. MY RUACH ha KODESH dem don quench. MY Prophets even have to receive their permission to prophesy. Woe to you evil shepherds. Woe to you evil pastors. You dey teach MY People a lie. You no go even teach dem di True Sabbath. You tell dem say any day go do. But I ask you dis question what was good enough for di Creator e no good enough for you?

So run little Sheep and run little Lambs. Those wey dey full of MY anointing and MY RUACH ha KODESH, run from di churches of Babylon so that dem no go cave in on you. Run from di iceboxes of di Mausoleums. So that I can fill you with MY Fire of di RUACH ha KODESH becos di Churches of Babylon say one religion na di same as another dem tell you say God na just love, one world religion na di next step to di anti-christ.

Oh na true say I get a few churches, Oh but so very few dey full of MY RUACH ha KODESH. So very few dey full of MY love, so very few dey preach di truth, no be any church on a Sunday go do. I dey speak to di people wey dey dis churches now go to your pastors and tell dem di truth. Remind dem of di Ten Commandments wey I don give you. Remind dem say di Sabbath was set up from creation when I form dis world. Then that pastor will be hold accountable whether him go teach di congregation di truth.

YAHUSHUA dey come back on a Sabbath. Will you be di 5 wise virgins or di 5 foolish ones? I no dey come for a disobedient Bride. There are qualifications to become MY Bride. Oh how I dey sorrow and oh how I dey cry for those wey think say dem be MINE and yet di RUACH ha KODESH di HOLY SPIRIT no even dey inside dem. I look into dis churches of Babylon and I see nothing but dried up bones.
Crooked Pope with his crooked Scepter I look at di one wey dey sit on a throne, dey carry a scepter  dey wear a crown, dey issue his commands, millions of people dey worship am worldwide and yet MY RUACH ha KODESH no dey inside, instead na di anti-messiah spirit dey inside am. Just as in di times of old, dem request for di life of those wey no worship am, na so e go be again as he go makes a deal with satan, as he go make agreement to take Israel, there is no CHRIST for inside di man and even di staff wey he dey carry go tell you dis. Oh how I cry and how I weep at di masses of people wey dey lie down prostrate and worship at his feet.
Click Here To Learn Di Significance of di Cross wey di Pope dey carry
http://www.allmightywind.com/fastfood/prophecy/twistedcross.html

Dis na Babylonian religion, di one wey hate di true Sabbath. Becos dis man-made Sabbath MY true children go avoid. Go to your pastors and warn dem and if dem will not listen, then run. For you go don prove say di RUACH ha KODESH don truly speak thru you. Children run from di churches of Babylon becos a crashing down dey come. Di Crystal Cathedrals na foul smell to MY NOSE. Di pastors wey no go even speak di truth, say homosexuality na abomination unto ME. Abortion na murder; sexual intercourse without marriage na fornication.

MY true children dey desire to please ME. Be Holy as I am Holy. Hide MY Words inside your heart. Memorize Psalm 91 and put ME in remembrance of MY Word. Becos truly I AM coming again and I AM coming to catch MY Bride away. But you dey loyal, are you faithful? I no go take a wife wey no dey faithful. I no go take wife wey no dey loyal. I no go take wife wey no dey put ME first even if e means say her life dey on di line. No worry wetin human being can do to your body. Worry about di destruction of your soul, about going to hell and di Lake of Fire, becos dis na where di unfaithful go go. It is better that your name never ever dey for di Lambs Book of Life than to be remove out becos you be unfaithful wife.

Di evil don grow more evil but di GODLY don grow more GODLY, dem get more wisdom than di evil shepherds wey dey sit in di churches of sin. So run MY Children, run from di churches of Babylon. Those wey dem don rejected, those wey dem don cast out, those wey dem don ignore, those wey don speak di truth and even prophesy and di thing wey dem receive from di pastors na hatred and laugh. Dis ones na MY true Mighty Warriors. Dis na di ones wey I wrap MY hand around. Dis na di ones wey di Fire of di RUACH ha KODESH dey burn bright.
Stop sorrowing MY Children those wey dem don kick out of di churches of Babylon becos you have been rejected by satan, not rejected by YAHUSHUA your MESSIAH. You have been rejected by di spirit of di anti-messiah. So rejoice MY Children becos dis for no happen if MY RUACH ha KODESH no truly dey for inside you.

You be di ones wey can hear MY voice. You be di ones wey want MY every footstep. You be di ones wey dey desire to be Holy for ME. You be di ones wey I go use and greater works nain you go do, as together all of una go join together, all those wey I don call out of di churches of Babylon. For di great apostasy don already take place for majority of di organized churches, dem don sell demsef like a prostitute to di highest buyer. So no sorrow MY Children when I tell you to run away from di churches of Babylon instead make you rejoice MY Children becos you no need to  have to dey for inside a building to sit down at MY feet. I tell you di truth MY Children that na when you go start to eat MY meat.

Remind your pastors of di Torah and remind dem say di Sabbath was set up from di creation as di Book of Genesis talk am. Remind your pastors say di Sabbath na something wey no go end e go be forever more; dis thing dey inside MY Holy Scriptures. I no go change di Sabbath Day for human being although, di Sabbath was created for a sacred rest for all of mankind.
Dis na sacred day set apart wey dey bring closer fellowship with ME day dey bring restoration, a day that is to be Holy and set apart from di other days  wey you dey serve and worship ME. I place MY Seal of protection on MY Babies, Bride, Chosen Ones and Elect who dey do dis as a remembrance of their Creator YAHUVEH and their only Savior YAHUSHUA.

Pastors now I hold you responsible for wetin you now know. Repent and stop leading MY sheep astray. I forgive you for wetin you no know before, but now you no longer go fit stand before ME and say, “You no know.” I go remind una wey be pastors of di day wey I send MY Baby Lambs and Sheep to warn you to teach di truth so MY Children go dey ready on their Wedding Day.

Oh MY Babies, Bride, Chosen ones and Elect you have been so deceived by wild beast wey appear to look like sheep. Dem don creep in among una where una dey congregate. Dem eat up MY lambs becos di lambs no fit recognize di wild beast wey wear di mask of a sheep. Many of di well known Pastors, Evangelists and deliverance ministers, and many Christians go know their names, dem dey truly worship another god, even when dem dey call upon di name of Jesus and yet in reality dem secretly be 33rd degree masons, [occult].

Dis evil wild beast dey worship and serve satan  dem dey prepare di lambs and sheep as a sacrifice as dem dey read di Holy Scriptures and twist dem to line up with their image of their god and dey manipulate di Holy Scriptures dem dey make excuses for their own sins. Beware MY little Sheep and Lambs! Run from dis Babylonian Pastors and evangelists, dem no get MY HOLY SPIRIT for inside dem. Dis evil ones don take blood oath becos all 33rd degree masons don take blood oath to satan, swearing allegiance to him, even dem dare to use di name of “I AM” but dem avoid di Name of YAHUVEH and YAHUSHUA yet dem no fear di name of Jesus or Christ.

Beloved dis no mean say all those wey dey use di name of Jesus Christ instead of using MY sacred Name of YAHUSHUA na evil beast or 33rd degree masons. Many many of MY Children around di world dey call ME Lord Jesus Christ. Make you no fear, be assured say I know who MY Children be. I put you in remembrance say MY Holy Scriptures warn of those wey go come and dem go say “Lord, Lord we no prophesy in your name and in your name we cast out devils and in your name wey do many wonderful works”? And I go say “I never ever know you, depart from me you wey dey do di work of iniquity” (Matt 7:22-23)

Dis evil beast don fool di people but beware you evil Pastors wey dem dey show  for TV stations worldwide and radio airwaves, beware becos you no dey fool ME, I know your works say you claim to do am in MY Name and yet you dey do dis false manifestations under di occult powers of satan. You go reap wetin you don sow and that na hell and di Lake of Fire. When MY Judgment fall down e go be as if a giant hand punch am or swallow your man made temples to di ground. Crashing glass houses go fall down.

New age Pastors you no dey hot and you no dey cold and I go vomit you come out of MY mouth. (Rev. 3:16) Beware I know your works you only want to speak of Heaven and no to warn or even believe say  there is a very serious consequence to sin and that na Hell and di Lake of Fire. You evil Pastors wey dey lead people astray, you dey fear of teaching about Hell and di Lake of Fire becos you know say that na your next home! Be not deceived, again I say to di Babylonian churches becos ME,YAHUSHUA, go judge you and your works and your money and your popularity no go save you in that coming Judgment day. (Rev 2)

You wey dey serve satan and call yourself 33rd degree masons, you wey dey call yoursef illuminati there is no illumination inside you. Di God of creation create hell and di Lake of Fire for another reason and na for di fallen angels and satan but na you wey dey continue to choose to stay in rebellion and to serve di god of disobedience and rebellion and di anti-christ and you go spend eternity in damnation becos you refuse MY Salvation. Test di fruits, MY Children.

IF any Pastor no line up with MY Holy Word then run from dis Pastor. Di church no be di building; di church and di Temple na MY People wey dey gather together in MY Name. Be not deceived by popularity and riches, by di size of a church or Temple or congregation. Be not deceived by di false manifestations of wetin some people dey call miracles and yet I tell you say na Witchcraft and juju. I tell you say na di occult nain fills so many of your churches and yes, Christian airwaves. How long MY Children, must I wait to come and get MY Bride? I tell you how long, until MY Bride stop to be disobedient and start to obey wetin dem know to be true and start to run away from di evil for di majority of churches wey dey out there. If you hear MY voice for dis prophecy and run away now from di Babylonian churches then you no go sit down inside di fake churches when di antichrist go come in dis churches and go stay and dem go worship am.

Na under di anointing She speak dis Prophecy and na so dem take write am under di anointing of di RUACH ha KODESH. Please no stone dis messenger in fact please cover me and dis ministry in prayer for protection. Dis prophetic message na only for di Children of YAHUSHUA also called di Lord Jesus Christ. Dis prophetic message na for those wey fit hear with their spiritual ears and discern with their spiritual eyes di truth that has been spoken in dis prophecy all others no even concern yourself dis message no be for you and you be like di evil pharaoh and go remain spiritually deaf to fi words of dis prophetic message.

I see vision as YAH dey speak dis word to me and I see inside di churches heap of dead dried up bones skeletons wey no join together just heap on top each other one upon di other, life enter into di dead bones and dem become complete skeletons wey come dey jump and runn as flesh come upon their bones as di truth come upon dem and dem know say di truth for dis prophecy don set dem free.
I humbly submit dis to you in di Name of YAHUSHUA.

A Woman Servant, Child, Warrior and Bride of YAHUSHUA.
Come YAHUSHUA come quickly in di name above all names YAHUSHUA ha MASHIACH
(YAHUSHUA the MESSIAH)

Apostle Elisabeth Elijah (Elisheva Eliyahu) 12:20 pm 10/16/02

Please share dis with others so that di truth can set dem free also. In di name of YAHUSHUA ha MASHIACH I pray.
Na so it is spoken na so it is written and together we pray Father God YAHUVEH say we go be found worthy to escape your wrath and di Great Tribulation wey dey come in di name of YAHUSHUA ha MASHIACH (Luke 21:36) and to be included in di only church wey go be caught up alive to meet YAHUSHUA in di air as it is written called di church of Philadelphia (Rev. 3:7-12). Amen.