PROPHECY 65, GET READY! GET READY! GET READY! BE PREPARED, BECOS DI EVIL DAYS DEY UPON YOU!


PROPHECY 65
GET READY! GET READY! GET READY! BE PREPARED, BECOS DI EVIL DAYS DEY UPON YOU!

Dem Write and Speak dis prophecy under di anointing of di RUACH ha KODESH
thru Apostle Elisabeth Elijah (Elisheva Eliyahu)
Nov. 29 2002 ending at 3:50 pm

Dis na from Prophecy 105, YAHUVEH say to put dis up for all Prophecies from now on: I warn you a long time ago Elisabeth [Elisheva], make you no call dis Ministry after a man or a woman name.
Even before dis Ministry start, I put am for your spirit. Becos nothing wey dey here come from your hand.Nothing wey dey here commot from your mouth. Na from di Mouth of YAHUVEH dis take come out. Na from di Mouth of YAHUSHUA, your MASHIACH, na dis take come out.
Na from di Mouth of di RUACH HA KODESH, your IMMAYAH, na dis take come out. If to say na by your hand e for don fail long time ago. Na by di SHKHINYAH GLORY Wind
wey dey blow across dis earth, di HOLY Wind of Revival. No be by your breath, or e for don fail. Isaiah 42:8

For July 2010, YAHUVEH GOD also say to add di following as a warning to those wey dey mock:
But dem mock di Messengers of GOD, despised HIS Words,
and no take HIS Prophets serious, until di Wrath of YAHUVEH
arise against HIS People, till there was no remedy.
2 Chronicles 36:16

* * * * * * *

Dis na di first Hanukkah prophecy wey I receive. During a time when I least expected am as I dey pray for our sister in YAHUSHUA wey dey go thru some marriage problems as her husband dey prepare di Christmas tree, she no fit hold back di truth wey she learn thru dis ministry and how Christmas really no get anything to do with YAHUSHUA.
We been dey pray for peace wey pass all understanding for her and for di truth to set her husband free. As I start to pray in tongues dis prophetic message come out and we tape am. We no even get di time to even light di Menorah, instead YAHUVEH tell me say he don give me fresh RUACH ha KODESH Anointing Oil to share with di people. No be just to light oil lantern but to share dis RUACH ha KODESH anointing wey be Hanukkah gift to di world for all those wey get spiritual ears to hear and spiritual eyes to see di truth wey go set dem free, in di name of YAHUSHUA. One different thing wey I found as YAH dey speak di prophetic message thru me; I can clearly discern di different as YAHUVEH and YAHUSHUA dey speak forth some times. Happy Hanukkah, Apostle Elisabeth Elijah (Elisheva Eliyahu).

GET READY! GET READY! GET READY!
GET PREPARE, BECOS DI EVIL DAYS DEY UPON YOU!

Given to Apostle Elisabeth Elijah (Elisheva Eliyahu)
Nov. 29 2002 ending at 3:50 pm


Get ready, get ready, get ready. Get prepare MY Children becose di evil times dey come upon you. I no dey send out dis nation to go into war. If dem want war, dem go get war, but e go be MY weapons di weapons of Heaven di arsenal of di weather, di arsenal of di elements. I go shake di nations up, those wey dare to defy ME and boast in their own strength go see say their strength don come to nothing, e dey empty and e no get power. Di leaders of dis nation no dey wrestle against man. Di leaders of di United Nations no dey wrestle against man; instead dem dey wrestle against ME, YAHUVEH, di GREAT GOD “I AM.”

Dem say “I go do am my way and not YAHUVEH’s way.” Those wey hold di power for dis world with their inventions think say dem go fit control di weather and di elements but I AM about to suprise dem as I turn their own weapons against dem, their own machines, their own inventions, their own poisons wey dem dey seek to give others na dem go drink am demself, not even their loved ones go dey protected although dem say dem go do am.

Those wey dey insist on celebrating [heathen] holidays and wey no dey observe di Torah to recognize, to esteem di true Holy Days, go find out say dem go feel MY wrath in a mighty way even those wey dey call demsef by MY SON’S Name becos dis truth don set dem free (say make dem dey Holy as I AM Holy), but instead dem insist to continue to participate, and dem dey wait to celebrate am, and dem dey enjoy to celebrate dis pagan holidays. Then dem no go feel MY presence, dem no go hear MY Spirit speak to dem, dem go find out say dem no longer dey inside MY ark where I set MY Children apart.

Oh MY Daughter I know say dis words you no want to speak am, becos those wey you once call dem friend you go call enemy, but know dis say you don do am MY way and not your way. I dey use dis ministry to prepare di Bride of YAHUSHUA. I tell you once befor and I dey tell you again; I no dey come for a disobedient Bride. MY SON no dey come for a disobedient Bride. Either you be MY Children or you no be MY Children. Lightness and darkness must separate, I dey take MY dividing sword and I dey separate di thing wey no be ME ever join together. But I do am for di safety of MY Children, those wey truly dey seek to follow YAHUVEH and YAHUSHUA, those wey dey filled with MY RUACH ha KODESH.

MY Children, di churches dey teach a lie becos only di most Holy are called MY Bride! There are requirements to be YAHUSHUA’s Bride and one of dem na, although say you dey for dis world you are not to behave like dis world. You are to remain Holy and Pure before ME, dey washed in di Blood of MY SON at Calvary. I don anoint you MY Daughter to speak out from dis ministry to help prepare di Bride for that wedding day, to help dem to get their lamps filled with MY Holy Oil and even get more Holy Oil remain over for extra. I dey use you MY Daughter as di truth is spoken out. I dey use dis mighty ministry to separate di chaff from di wheat. Yes di attacks have been great. Oh but di rewards dey so much more. Remember MY Children, I say, “Go and hide for just a little while, while MY storm pass over.” For as I don give you di dreams tornadoes go come like wey nobody don ever see before. Di earth go quake and shake as I take both of MY feet and stomp am.

Becos I dey angry and I dey full of wrath for did I not say, “ no put other gods before ME” wetin you do before becos you no know I no go hold am against you, but wetin MY church dey do with knowledge na that dey truly make ME angry. Tsunami waves go come; e go be MY hand wey go stir dem up in di sea. Again and again I give dis warnings, wetin e go take for your knees to bend to ME? No longer wey I go stand for a form of godliness. Those of di lukewarm church your prayers na abomination unto ME. I don warn and I don warn wetin I dey do with di lukewarm, I go spit dem out and vomit dem out of MY mouth. You be like bitterness wey dey rise from MY throat. You dey make ME sick and “I AM” YAHUVEH and satan dey mock ME and say, “Look at your lukewarm churches wey dey preach lies and dem dey do am in YAHUSHUA’s Name and dem no repent or turn away from following dis pagan way.”

But MY beloved children, those wey dey filled with MY RUACH ha KODESH I no dey angry with you. I hug you, I cover you with kisses, and when you fall I dey there to lift you up and brush you off and carry you in MY arms. You wey dey seek di truth, di complete truth, and wey no go receive any lies, yours na di ones MY Children wey your lamps I fill am to overflowing. You be di ones wey di Shkhinah Glory dey shine bright thru, for your bodies na di lights di lamps wey I overfill with MY RUACH ha KODESH and you get more for extra becos you dey minister to others in YAHUSHUA’s Name. You know say dis oil dem no dey buy am but e dey come with a price, and that na to be ye Holy as I am Holy. Keep your minds Holy, keep your bodies Holy before ME and di only way that can be done na thru di shed Blood of YAHUSHUA ha MASHIACH of Calvary.

I give MY Daughter di dream dis day that she was poisoned and every time wey you eat food MY Children you no realize wetin you don put inside you. Di hormones wey you ingest, di pestilence, so ask ME how to cleanse am and I go show you MY Children becos di body na di Temple of di RUACH ha KODESH and it must be cleansed. You go find out say you go even hear from ME more easily. There is a war for inside your bodies, no be just spiritual na also physical, becos I no go only cleanse your spirit, I no go only cleanse your blood, I go wash di poisons come out of your blood, out of your body, out of your stomach.

Becos wetin dey come MY Children, while you dey in dis ordinary body of flesh and blood you must be prepared, you must be strengthened, you must be healed, becos sicknesses don come upon you wey you no know. Di air dey poisoned and you no know. Di food dey poisoned and you no know. Becos you don asked a blessing on di food wey you eat and di drink wey you drink I dey faithful to show you wetin to do. Sometimes MY Children protection no be by MY supernatural hands but you must also partake of it in di physical realm. So cleanse your bodies, MY Children, just as you cleanse your spirit and your soul, prepare your bodies, MY Children, becos there is yet a war coming wey you no know.

No trust in di governments of dis world to protect you becos you go no find protection there. Trust in di God wey create you wey know every molecule, every atom, every cell, every one of your DNA and each one of you na individual but I know each one of una by your God given names. Pray to ME and I go give you wisdom, I go bring others into your way becos I don raise up di hidden ones to give you wisdom at dis time, to take care of dis Temple of di RUACH ha KODESH. Use everything wey I don give you for YAHUVEH and YAHUSHUA’s glory while you yet get am to use. satan dey look for how to take everything from but no worry MY Children, I go cover you. t can pass all di ungodly bills wey dem want your politicians and your leaders; na only wetin ME, YAHUVEH, allow nain go come to pass.

No worry MY Children, I no go ever leave you or forsake you as long as your ear dey incline to MY ear, as long as you dey listen when I speak, as long as your prayers no be abomination unto ME, as long as you dey desire to be as I am Holy, as long as you dey keep di Torah and no throw am out. Becos dis no be two books, dis na one book. Man nain divide am, one dey support di other becos di book of di aged and di book of di new na truly one. Just like ME, YAHUVEH, and MY SON YAHUSHUA, I AM in MY SON and MY SON dey inside ME, so na di same with di aged Book and di new Book. Study and show yoursef approved, study and show di knowledge wey I give you. Dem don translate di Book again and again seek ME to find out which translation to study for more than one language than Greek. Study di Hebrew, Study di Aramaic, read and listen to wetin MY Word really talk no follow di pagan ways of man di heathenistic ways wey dey bow down to idols and just like Shadrach, Meshach and Abednego I go protect you in di fiery furnace when e come.

Dey Enlightening some, dey offending others in di name of YAHUSHUA ha MASHIACH
Apostle Elisabeth Elijah (Elisheva Eliyahu)

Dis prophetic word come at an unexpected time when we dey lift up another sister in prayer wey her marriage was divided and she just dey leave and we just lifted her up in prayer. Becos she desire to follow di ways of YAHUVEH and YAHUSHUA dis anointing come upon me and that na when dis prophecy come.