PROPHECY 49, Be careful You Be Like Sheep Wey Dem Dey Take To Di Slaughter


PROPHECY 49
“Be careful! You Be Like Sheep Wey Dem Dey Take To Di Slaughter!”

Dis prophecy come to Prophet Sherrie Elijah (Elisheva Sherrie Eliyahu)
Dis prophecy come on di first day of Sukkot
( Estarts in di evening of October 2, 2001)

Read di Message wey relate to dis prophecy From Apostle Elisabeth Sherrie Elijah (Elisheva Eliyahu)
Emails From Visitors Concerning Dis Prophecy
(Click Here To Go To Emails)

Dis na from Prophecy 105, YAHUVEH say to put dis on top of every Prophecies from now on: 
I warn you a long time ago Elisabeth [Elisheva], make you no call dis Ministry after a man or a woman name.
Even before dis Ministry start, I put am for your spirit. Becos nothing wey dey here come from your hand. Nothing wey dey here commot from your mouth. Na from di Mouth of YAHUVEH dis take come out. Na from di Mouth of YAHUSHUA, your MASHIACH, nain dis take come out.
Na from di Mouth of di RUACH HA KODESH, your IMMAYAH, nain dis take come out. If to say na by your hand e for don fail long time ago. Na by di SHKHINYAH GLORY Wind
wey dey blow across dis earth, di HOLY Wind of Revival. No be by your breath, or e for don fail.    
Isaiah 42:8

For July 2010, YAHUVEH GOD also say to add dis one as a warning to those wey dey mock:

But dem mock di Messengers of GOD, no gree to hear HIS Words,
and no take HIS Prophets seriously, until di Wrath of YAHUVEH
arise against HIS People, until there was no more mercy.
2 Chronicles 36:16

* * * * * * *

Be careful! YAHUVEH say we be like Sheep wey dem dey take to di slaughter. Even many of di pastors dey set up di Sheep and Lambs for slaughter.

* * * * * * *

Prophecy Begins


Woe be unto MY Churches and Temples, wey no dey lead di people to pray against war in America, dis World War III go affect every nation for dis world. If you no dey do dis  thing make you no call yoursef a church. No call yoursef MY Pastor, Prophet, Apostle, Teacher, becos you no dey hear from MY anointing if you no fit hear dis now. Spiritual leaders, you go answer to “I AM” YAHUVEH for not leading di people to pray against ID cards and other invasions of privacy. I go hold you accountable becos you no speak out against as dem dey take your freedom and privacy away. You dey freely giving am away. America no realize di kain price wey dem have to pay to get dis freedom, to keep dis freedom? Becos you no go see am return again until YAHUSHUA come again after di Tribulation.
Pastors, Woe be unto una. Especially you wey get di most to gain for your eyes, becos you take your tax-exempt status and you sell yoursef to di highest bidder. You be prostitute for MY eyes! You churches wey never speak out against, or tell MY People that it was wrong on di day wey you dey call assembly di day of remembrance and prayer, you dey grieve MY RUACH ha KODESH (Holy Spirit) deeply, becos you no dey teach and you no dey speak out di warning. Na sin to pray to any other God but YAHUVEH and YAHUSHUA (Jesus)! Dis is wrong and you no let di government know about dis, how di enemies for other nations dey mock you America. Becos no other place but in America wey dis kain thing dey happened. You were set apart America, for MY glory, and then to say, any god can answer prayer. You compromised with souls. You go answer one day for dis thing at MY judgment seat.

Shame on all of una wey keep silent wey  no do anyhing to take away di evil of dis  to even show for your television. So ME your Father God YAHUVEH no go be angry with America again, I put am for Pat Robertson mind, to pray for di pastors, but he no even say why I do dis thing. He know say di pastors compromise and yet he fear to anger dem more than angering “I AM.” Woe to di pastors in America and around dis world, I rebuke you, “No longer behave like cowards.”

No call yoursef a pastor, prophet, apostle, teacher, evangelist, a spiritual leader if you be coward! Step down now before I hold you anymore accountable for leading MY flock astray. Stop teaching MY People to compromise becos in di olden times dem fight for di right to serve “I AM.” Those wey follow YAHUSHUA dem kill dem but dem no compromise.

MY Church, rise up once again and become di living Temple of MY RUACH ha KODESH. Stop feeding MY Sheep and Lambs baby food wey only dey good for small babies. Shame on you. I go hold you accountable, you pastors wey compromise and wey no gree call Unholiness wetin e be. Those wey compromise no go inherit di Kingdom of Heaven. You dey fear your own deacons, congregations, and government more than “I AM.” How can I continue to pour out MY blessings, and protection if you continue to compromise wetin you know to be true, wey you can back up with di Holy Bible and scriptures.

I charge you pastors and accuse you now. Shame on you! You dey only speak wetin di government and congregation wey buy you dey tell you to say. Pastors you don warn who di terrorist of America be, but you no warn who di enemy of YAHUVEH be, and di true enemy of MY Children, di name na satan and satan  dey come in many forms, in various religions. Satan dey push you to fight war wey him know say go  be a war wey go lead all nations to join in one way or another. Be careful when you next call dis World War III that na exactly wetin e go be.

America, you are being deceived. Wake up MY People and speak up against dis thing, encourage your President to find more peaceful ways to take do things instead of war wey go even include biological, and germ warfare. Dis no longer be war wey dem dey use just ordinary bullets. Dis go be war so mighty wey go shake dis world and truly di words World War III will never be forgotten, and no one country go remain di same. You have been warned!

America, you dey make ME sick with your songs of God Bless America. Which  God you dey sing dis song to? I hear your day of remembrance and prayer, I witnessed di silence, and all of Heaven also watch in silence, as I hear a nation rise up against ME, YAHUVEH, as una gather in prayers, Churches, Temples, Mosques, homes, and streets, but how many of una pray to di  God of your creation. How many of una pray in di Name of YAHUSHUA di God of your Salvation. WOE be unto you. I hear your leader say just pray to whatever god you dey worship.

I see your government leaders even dey pray in di name of a foreign god. Wey be ordinary man, di devil dey come in many deceiving appearance. Di audacity! Na becos of di prayers of MY People wey dey beg for mercy on America, nain make I no remove MY hand of protection from una again on that day. Na because of di very few wey dey your government house nain make I spared America again, on that very day, when dis wickedness was raising up, I hear di prayers of di fervent righteous fill MY ears louder than di ones wey dey try to please every religion.

America, stop testing ME. Woe be unto a little baby wey dey shake their fist in di face of di Almighty Living God YAHUVEH, there is no other. “I AM” who “I AM” and there is no other God. America, if you no stop waving that red, white, and blue flag for “I AM’s” face and start to live Godly, raising up di bible, obeying di Torah, wey be di Godly standard against di evil in dis world, as well as di evil wey dey come against your country. “I AM”  go remove MY hand again on you and allow satan to give you a beating, where di tears no go stop, or di wails of dis nation wey every body go hear around di world. A satanic nation go beat you and make una body look like dem use red, white, and blue cane to beat una.

I go allow satan to put that kind of wounds on you, if you no stop dis prideful, arrogant attitude. Dis attitude, that dis nation is perfect and never do any harm, or wrong. Your pride dey smell reach Heaven and dey cause ME such shame, as all of hell dey rejoice and you make satan to mock ME, reminding ME how much MY grace and blessings have been poured out on America. For doing dis beware becos di price wey you go pay if you continue go be di same with di one wey Babylon pay, and you no go rise up again. Truly Babylon go fall but e no need to be now. Satan dey seek to go ahead of MY time and I dey wait for true repentance America.

Make your nation no take pride in a flag wey dem use colored cloth take make, becos for di most part na di hand of your own enemy wey dey seek your destruction make am, and na your enemy hands sew am. Becos when di nation wey dey make your flags, sew dem, you no know but dem dey  put their curses on your flag, and everything wey e stand for, and dem dey pray to their gods for di destruction of America. Oh America, how I dey sorrow for MY young child of a nation. So spoiled, abi I don give you too many blessings? Becos truly I don bless you where di world dey envy. Oh America, I give you more than di rest, and you dey behave like a spoiled child wey only dey seek more, and asking me to expect less of you. Repent before it is too late. Turn back to ME; no pledge allegiance only to ordinary flag, pledge allegiance to di God of your Creation and Salvation, YAHUVEH and YAHUSHUA na OUR NAMES.

Oh America, I dey weep and wail over you. I send you out to other countries with di Gospel of MY Son YAHUSHUA and your own country dey turn their backs on ME, except in times of great worry. Why be say I have to remove MY hand of protection from you to get your attention? Do you think say I dey enjoy to see you suffer before di eyes of dis world? Did I not say thru dis Woman Servant, “America I don save di worst for last for you?”

Do you not know say na only you dey in control of your own destiny? When America open di floodgates and allowed every religion to come to their land, do you really think say I been want una to welcome all di foreign gods wey strangers bring with dem? Una don so soon forget una heritage and how you first take begin? Una don so soon forget di miracles wey I do to give birth to dis nation?
Oh America, do not so easily give up your freedoms, wey I don give you. Oh America, do not so easily forget say there is but one God and na “I AM” dey cover and protect you. “I AM” di same Creator wey create you for MY own purpose! I use you to test di other countries of dis world. Whether Dem go follow your sinful ways, and yes MY young child America, you have sinful ways, and becos of your example you don fill up dis world with di example of Unholiness. You send di evangelists out with di message of salvation, and yet how many for your own country dey eat di fruit of damnation, unrepented sin. Dey call wetin dey Holy, unholy, blasphemy for MY eyes.
Oh America, Come let us make peace with one another. You dey sing God Bless America, but you no know say di Buddhists dey say, dis na their god you dey sing to for America in that song, as well as di Moslems dey say that na their god and satanists dey say that na their god. Name which God you dey serve and Name di Name of di only one wey be your creator, and your Savior! Name di Name YAHUVEH and YAHUSHUA ha MASHIACH also called by some as Jesus Christ. Dis na our NAMES and they should be everywhere on every airwave. Are you so ashamed to call upon YAHUVEH that you don even block out MY Name from your schools, to your courthouses? Why be say every other name dem allow for America, even those wey dey serve foreign gods?

Strangers wey come to America, and yet dem  no dey shame to mention di name of di ones wey be ordinary men, di devil in disguise, and yet dem dey call gods. And yet you wey dey set apart for MY glory dey shame to say di Name above all names. Then you dare to call upon ME for mercy for America. Oh if to say no be for di intercessory prayers of MY true Children I for don allow America to be removed from di face of the earth already.

For the sake of MY Babies, Bride, Chosen Ones, and Elect wey dey America as well as those wey dey cry out for America in other countries I for don wipe you from MY memory by now. Dis na how much you don anger ME and yet as angry as I AM dey how much I dey weep for you, and ask you to repent, becos I no want anyone to perish and go to a place wey I no create for human beings, but instead for satan and demons. Dis place was created for di angels wey fall away.

America, Yes I don wrap MY hand of protection around you again. See wetin go happen when I remove MY hand? See how fast others wey dey jealous for di blessings wey I don give America  attacked your country? If you want to know di truth, America you have no friends. All of dem na enemies in disguise and if possible dem go destroy and take away all you have. “I AM” na your only true friend and “I AM” na your Creator and Father. Why you dey shame of who “I AM” be and wetin “I AM” dey stand for and that na Holiness, and wetin “I AM” dey stand against and that na everything wey dey Unholy. Repent America before it is too late.
Oh America, you are so young and so foolish. You think say  I dey impressed with prayers wey you said pray to other foreign gods wey be ordinary men and di devil in disguise? Your day of prayer and remembrance do very little to honor ME; I only spare your nation again becos of di fervent prayers of di righteous does availeth much. Do you know say satan ask MY permission to crush you on that day? I refuse becos of di fervent prayers of di righteous ones availeth much.

Beware America, becos di next World War III go be di beginning of di end for you and many other nations go fall when you fall, like dominoes in a row. Like a house of cards. Beware and think hard on dis, for how can I bless you to win a war when dis nation no longer dey stand for Holiness. You leaders dey more interested in pleasing all di people than pleasing and fearing di God of Salvation. MY Son Name na YAHUSHUA and whether you call HIM by HIS sacred Name or di name wey dey Name wey dey more common for America Jesus HE still be di same MESSIAH for eternity and there is no other. YAHUSHUA na di only way to come to “I AM,” there is no other God but di Holy Trinity for all di three are one.

Beware, of di false messiah wey arise all around you. Beware, everything wey dey for inside Bible satan dey seeks to counterfeit am. Beware becos MY Babies, Bride, Chosen Ones, and Elect, will be deceived if to say e dey possible. Becos satan dey come as a angel of light, and dey pretend say na for your own good, to protect you, and yet beware becos when you turn to anyone for protection before you turn to YAHUVEH and MY Son YAHUSHUA, you don fall into di trap of deception and deceit. Beware when I say to whom YAHUSHUA don set free is free indeed. And then di powers of dis world go come and take your freedom of speech, travel, even how you dey sow your seed away from you. Beware becos di evil ones go even try and ration wetin you eat, drink, wear and which day you must worship.
Worship ME every day, but there is but one True Sabbath and that na di day wey YAHUSHUA give you as he set di example and become Lord of di Sabbath. Worship and praise YAHUVEH and YAHUSHUA every day, but especially on di True Hebrew Sabbath rest in YAHUVEH becos I rested after I created di world. Who are you, a ordinary human being to think say you also no need rest.

Follow MY Torah. Honor di True Sabbath day and keep am Holy before ME. Rest on dis day. Seek to hear from ME on dis day, ask ME wetin I want you to do on dis day, separate yoursef from di world and honor di God of your creation and Salvation. Will a man rob God? Yes, even di true Sabbaths dey set apart for you and “I AM” becos you see dis go be for now and eternity a day of rest.

Just Look which day wey di world dey go club, and na in drunkenness, sinfulness, e dey everywhere and know say dis na deception of di devil to anger “I AM” becos so many people just no understand which day be di True Sabbath. Read your scriptures, does not MY Word say, “Work 6 days and on di seventh day make you rest?” Dis no be legalism, dis na blessing wey dey reserve for you and “I AM.” YAHUSHUA go return for HIS Bride on di True Sabbath. But you no know which Sabbath HIM go return so be ready. Make HIM no find you dey drinking, partying, and working, as di world dey work or you go weep like di 5 foolish virgins with no oil in their lamps take cry. Light your lamps now and keep dem on, until you see YAHUSHUA return in all HIS Glory for HIS Bride wey dey wait for her Groom.
Beware becos di World Trade center just be like di Pillars wey Samson shake. America dis na where you put your faith, your trust, your hope, People of different language and country fill dis towers, and you build dis tower high, and if to say you fit do am e for even reach di heights of di tower of Babylon. Just like di tower of Babylon take fall before di world, I allow di towers to be knock to di ground. Now di land dey soaked with blood of di people wey die bury under di towers as a reminder of di sin of pride for inside those towers.

Nobody speaks of di sin that was inside those towers, di sins wey di entire world dey worship, di sin of greed, thief, blood money, in many different forms, sin in more forms than I can name. Di whole world drink from that cup of Babylon, when I remove MY Hand wey hold on you that day; di enemy enter in and attack. Di world watch in horror, as dem watch as your world towers burn in fiery flames and crash to di ground. I dey have mercy on your financial system for one reason. No think say na becos America dey so powerful, nobody can bring another economic depression again becos na di prayers of di fervent righteous ones in MY Son Name nain make I never allow di economy to also go crashing to di ground. Not yet! As long as prayers continue to go up and faith in “I AM” more than in dis government or any other government.

America, think long and hard before you involve youself in another war. Which country you go fight? You have not one nation to fight. You dey so small compare to di other bigger nations. You be like di youngest wey dey try to defeat di oldest. Di only reason wey you don win di wars in di past na becos dis nation for di most part turn to “I AM” and MY Son YAHUSHUA and know without US on your side you for lost every war. Even your initials na  “I AM.”  give you that Name US, YAHUVEH and YAHUSHUA na di US and A na for Almighty. Dis nation was to stand for United States of Almighty. But you once serve di Almighty Living God “I AM” and YAHUSHUA. It was “I AM’s” grace, love, mercy and wisdom I give to your political and spiritual leaders.

Who go listen now? Which spirit dey speak out to your leaders? Pray for dem. Your White House dey defiled and never clean from spirits of divination, adultery, murder, suicide, whoredom, fornication, greed, jealousy, antichrist spirits, abortion, homosexuality, pride, atheism, unlove, hatred, selfishness, bribery, lying and deceiving spirits, satanism, insanity, treason, necromancy, do I need to go on? Which spirit is in your White House now where your leaders dey make decisions? Where is di Blood of YAHUSHUA that should be used to cleanse your houses of government? Where is di repentance wey I called for in Washington DC? From your leaders wey dey responsible for passing laws of unholiness? People stand in di gap for your political leaders around di world.
America, no go to war without “I AM” on your side. No allow your politicians to think say you want dis war with an invisible enemy. Can you really fight 60 nations or more to root out di men wey you dey call terrorists? How can you hope to win? Oh America, you dey face a world full of bullies wey want very much to act as a friend and for di most part go betray you if dem get di chance. Dem go attack when you least expect am. You offer your hand full of money, and bribes, and dem hate you for it. You have been warned! America, you are so close to MY heart, becos even when your enemies dey thirsty and hungry you want to feed and water dem. Do you not realize say you dey strengthen your enemy at times instead of to weaken dem?

You dey heap coals of fire on di heads wey no dey acknowledge di God of your forefathers, dem hate you when you show dem love and compassion, and dem see you as weak instead of strong. America, even after war with your enemies you dey go and rebuild their land but you no go fit wipe away di tears wey you cause becos you are too quick to flex wetin you think say na your arms of strength, your muscles, and yet when the Holy Word of YAHUVEH no be hin dey strengthen your muscles you go find out say e go take more to do than wetin you been dey do with less.

Beware, di hand of di executioner, no trust your enemies. Beware of turning your back on di executioners becos now there is more than one nation and executioner wey you need to be concern about. I warn dis Woman Servant wey I dey speak dis thru, beware of Pakistan, and yet how few dey speak out and warn di leaders of dis nation? America, you dey smile and di nations wey you think say dey smiling back hold missiles behind their backs.

Warfare go harm you in ways wey never happen before. Only way dis go come to pass na if di fervent prayers of di righteous go continue to invoke MY RUACH ha KODESH (Holy Spirit) to cover America and repent and stand up for Holiness and in boldness rebuke Unholiness and call upon no other Name except di NAME of YAHUVEH and YAHUSHUA. Cover your President Bush in prayer, and woe be unto you when di next president come. Woe be unto you when di next Pope come. Becos dis next Pope no go be a man of peace, and will be controlled by satan.

Remember di Roman Empire and wetin e do. Words to di wise in YAHUVEH, pray now for di times to come, come upon you so quickly, for now is di time to get right with ME. I speak dis to di whole world for America, you can set di example, as Israel also. If only MY two children go listen then dis world for no have to drink of di cup of MY wrath. Ah, but it has been prophecy and already predestined, yet no rush MY timing! There is yet time if only everybody wey claim say dem know “I AM” no go remain silent any longer. Dis World War can be delayed longer; there will be no other, after dis go be a war against Heaven itself. Pray say make you dey on Heavens side and not on di side of di anti-messiah.

Now in closing I want to comfort MY Babies wey come to ME in tears, and dey fearful of wetin go come to pass. If dis words of wisdom you no disregard am “I AM” no give you a spirit of fear, but of power, love, and a sound mind. Thank ME ahead of time for your Glorified Bodies. Bodies wey no prison bars go fit hold, bodies that cannot be killed, bodies wey go still do wetin di saints do when MY Son YAHUSHUA rose from di grave. Na so also di saints rise up in Jerusalem as their Spirits join with their bodies and dem arose in di first resurrected bodies, to be a witness say YAHUSHUA dey  alive, rules and reigns, he is MESSIAH. Again, I say as e be then na so e go be again.

First YAHUSHUA come then di saints rise up and witnessed to Jerusalem. Read MY Holy Word as e be then na so e go be again. Dis na di dead in di MESSIAH wey go again witness to dis world; along with those wey dey alive and called MY Bride, say YAHUSHUA na MESSIAH, you dey Watch, dey wait, yet you dey do di work set out by your Heavenly Father, will be caught up to meet YAHUSHUA in di air. You no go be bodies of flesh and blood anymore, but Glorified Bodies, wey go accomplish more for “I AM” more than in di normal ordinary bodies of clay.

If you believe MY Holy Word then you go know say dis no be di first time wey “I AM” done do dis, remember Elijah of Old [for Hebrew, Eliyahu], and remember Enoch? Why you think say I can only do dis only two times, is not “I AM” able to do dis again and for those wey can believe in faith I go do am. Di time when di Children of Israel dey live next to di Children of Egypt, and yet di plagues no come near dem, even the darkness no affect dem. Dem put di blood of di sacrificial lamb over their door posts, now you have another sacrificial lamb, di only Holy lamb wey dey without stain or any fault. No sin was found in YAHUSHUA. So all those wey don wash their living Temples in HIS shed Blood at Calvary, for di remission of their sins, wey don repent and turn away from sin, wey dey loving and seeking YAHUVEH and YAHUSHUA first in their lives, dey filled with MY RUACH ha KODESH.

Just as in di times of di Evil Pharaoh, when di spirit of di evil pharaoh go come again, na so too di miracles go come again, like Moses and di Children of Israel. If you can believe, then miracles wey you never yet hear you go see. I go still have those wey go die for ME becos na their destiny and dem already know inside their spirits and dem dey prepared, but MY Children wey det put their faith in “I AM” wey dey listen to MY voice, go know wetin to do, and where to go, and go escape di hand of di enemy time and again. No be everybody go get a Glorified Body, becos no be all believe.

Some want to test ME and stay with their loved ones wey no dey saved. Have faith for di miracles needed, to try and warn dem not to accept di Mark of di Beast, others know say dem go get their Glorified Bodies, dis na why there is such division, both dey right. I don already put am inside your spirit if you be MINE, whether you go die for ME, or whether you go be di dead in MESSIAH, and you go die first, arise, or whether you go be caught up to meet me in di air while you still yet dey alive.

Stop dis foolish arguments. You never yet see say that na why I speak am so clearly to dis Woman Servant Sherrie Elijah [ for Hebrew Elisheva Sherrie Eliyahu] and say “First one rapture then another for those wey I love?” I love dem both! Di dead in MESSIAH wey arise, and you wey dey alive to be caught up to meet ME in di air. You no yet see, say that na why I speak am so clearly to her, and say, “ No Say that you are pre-trib, mid-trib, or post-trib, becos no be any of dis things.

 You never yet see say na becos all of una dey right. Even those wey believe YAHUSHUA go come again after di Tribulation, Abi HE no go come to rule and reign on earth as HE dey rule and reign in Heaven?” How much anger you don cause ME over dis foolish division. Can you now put dis argument to rest? Dis debate never cause enough hatred and hard feelings from MY own children wey satan dey rise up within you. Work together, not apart. Stop rejecting di apostles and prophets. You need di eyes and ears of di body of YAHUSHUA. Pastors, stop thinking say di flock no need anyone but you. Di flock no be yours but e belong to di only Good Shepherd. Enough is enough.
Wetin you go tell those wey go dey left behind, all becos you no allow MY Prophets and apostles to warn di Sheep and Lambs and di black sheep wey for come become white, but you were too busy filling your pockets with gold, to even care when di Sheep and Lambs go astray, as long as di Sheep and Lambs no call you to repentance. Di Sheep and Lambs dey eat di same food day in and day out. You fear anyone else to feed dem, in fear, di congregation wey I call MY Sheep and Lambs, go prefer fresh spiritual food from Heaven. Fresh new wine and go insist that their pastors, throway di old wine so di wineskin no go burst.

Pastors, you are held accountable for every soul that is lost in your congregation and wey miss Heaven becos you dey more concern with yoursef, you dey build your spiritual empires, and your reputations, you dey twist MY Scriptures, to change to how you want am to be, to explain your abundance. And MY Children dey go in lack, as you dey puff yoursef up with pride, getting rich becos you no dey speak di truth in fear say go offend di Sheep and Lambs. You be wretchedly poor for Heaven. Wear your tailored made suites and live inside your mansions here on earth, becos truly that na all you go have na wetin you have now on earth, you dey bankrupt in Heaven, no matter how good you may preach, and teach, MY gifts wey I no take away once you go di way of di world, so you don deceive many, but no be all MY Children becos I don give dem di gift of discernment and dem know you for di spirit wey now dey rule you, di spirit of mammon and greed. You are nothing more than a prostitute in MY eyes.

Your Crystal Temple go break to pieces as you continue to stand there in your pride of wealth and manmade glory. MY glory no dey inside you. Those wey dey seek to call you pastor, go one day experience di Glass Temple crashing to di ground, as I shake am, and everybody wey dey for inside shall perish. How few when dis happen go even see Heaven. Becos did I not warn you about seeking Spiritual leaders wey only be instrument to scratch your ears. You have been warned! Man made towers wey dey mock “I AM” go fall. Yes, even those wey see demsef as a tower unto demsef, and wey dey call demsef by MY Name and yet no longer even know ME. You shall fall, when di spiritual leaders fall, di Sheep and Lambs shall scatter, na so few go find di Good Shepherd again.

* * * * * * *

Dem write dis word, as YAH take speak on dis day of Oct.1, 2001 at 12:10 am. I release dis message and ask for forgiveness of YAHUVEH if I no write everything wey I suppose to write. I don do di best wey I know how to do, to test di spirit wey dey speak. Please let me know if you hear di voice of our Heavenly Father. I also need encouragement as dis prophetic messages dey stir up di enemies wey dey seek to silence dis Woman Servant of YAHUVEH and YAHUSHUA. Nevertheless I dey only look to please YAHUVEH and YAHUSHUA even if I no fit please people. Apostle Elisabeth Sherrie Elijah (Elisheva Sherrie Eliyahu). Also. Please no stone di messenger.

Dis ID card na di beginning of di Mark of di Beast. For my sleep I wake up with dis knowledge from YAHUVEH, wetin be ID card? na  di Mark  wey  go set you apart from others. Where di information dey go? Into a computer for Belgium wey dem dey call di “BEAST.” Be careful di beginning of wetin dey inside di book of  Revelation called di Mark of di Beast. Pray all wey dey call upon di name of YAHUSHUA no go dey here when dis go come to pass. Becos there will be no buying or selling without dis Mark. Tony Blair dey try hard to get dis thing into England. People speak up or forever shut up.

* * * * * * *

Emails wey we receive…
Di main thing wey I see for dis new word from Almighty God na dis. Unless di Pastors, Evangelists, Teachers, Prophets, Apostles, stop to scratch your ears, and start to tell di people di truth, dis nation go go down. You be one brave heart wey dey stand for truth. Continue standing and pray say others go follow your courageous example. Without di church standing together in true repentance, and crying out to God to forgive their compromise with dis world, fleshy things, and di devil, we are going down!

Dis word hang on di church wey professes to know di true God and His Holy Word. I turn on TBN and see Paul and Jan Crouch. He hold Koran dey tell millions of Christians for America how peace loving di Muslims be and say Mohammad was a good guy. Dis was about 2 weeks before dey attack di Twin Towers. Dis na example of di big ignorance wey di  pastors and preachers soak demsef  in today.
I see as dem  actually soak demsef  in false teaching and compromise. I see as dis day dey come 12 years ago, and I try to tell others . . . no one listen. Now you dey tell di world thru di Internet. Make dem better stand at attention and listen, and then take action, or we are going down!!! “Di compromise, oh di compromise don cause My Church to enter  dis sad mess, saith di Lord God. Flee from dis compromise or di wickedness of dis world go catch up with you and you dey soak with di evil of dis world, saith di Lord God”
Thank you Sherrie (Elisheva Sherrie) for your strong stand for GOD’S truth. I feel led to suggest say make you put dis message near di new prophecy on your website. E go back up di powerful words wey Almighty God di Great “I AM” give you. We offer our praise and thanksgiving, and give honor and glory due to di Father God, di Holy Spirit, and Yahushua, God our Savior. E go also wake others to wetin dey go on in di church world, but use your own wisdom. Love, Linda

* * * * * * *

Sister Sherrie (Elisheva Sherrie), I don finally read Message number 49 and I feel di Holy Spirit in every word. Every blessed anointed word sound out as“Truth” in my very soul and I praise Almighty God for revealing His very heart to us! I pray too say everybody wey read dis message go listen, and I go surely do my part in copying and distributing dis message to friends and my family. I realize my own imperfections, but I truly sorrow at di way wey people don forgot God in di name of “compromise” and don avoid di use of di only name thru which we can be saved “YAHUSHUA!”

Di prophecy na truly a wake up call to America and di world and I especially agree with di part about how everyone was jumping around dey wave di American flag and saying “God Bless America”. How can God truly bless us in our sin, rebelliousness and arrogance! Truly! Repentance and humility na truly wetin dey needed and I pray for all souls to return to di one True and Living God, YAHUVEH! Thank you Sister for being di vessel thru which dis timely and very direct prophecy take come to warn us before e go too late. God bless you always! Olga