Prophecy 47, To Warn You In Advance Na For You To Be prepared In Advance For Such A Time As Dis


Prophecy 47
To Warn You In Advance Na For You To Be prepared In Advance For Such A Time As Dis!

Given to Rev Elisabeth Sherrie Elijah (Elisheva Eliyahu)
April 21, 2001

Dis na from Prophecy 105, YAHUVEH say to put dis up for all Prophecies from now on: I warn you a long time ago Elisabeth [Elisheva], make you no call dis Ministry after a man or a woman name.
Even before dis Ministry start, I put am for your spirit. Becos nothing wey dey here come from your hand. Nothing wey dey here commot from your mouth. Na from di Mouth of YAHUVEH dis take come out. Na from di Mouth of YAHUSHUA, your MASHIACH, nain dis take come out.
Na from di Mouth of di RUACH HA KODESH, your IMMAYAH, nain dis take come out. If to say na by your hand e for don fail long time ago. Na by di SHKHINYAH GLORY Wind
wey dey blow across dis earth, di HOLY Wind of Revival. No be by your breath, or e for don fail.    
Isaiah 42:8

For July 2010, YAHUVEH GOD also say to add di following as a warning to those wey dey mock:
But dem mock di Messengers of GOD, despised HIS Words,
and no take HIS Prophets serious, until di Wrath of YAHUVEH
arise against HIS People, till there was no remedy.
2 Chronicles 36:16

* * * * * * *

Prophecy Begins


To Warn You In Advance Na For You To Be Prepare For Such A Time As DIS! Yes di temperatures for Hell dey rise up. You never yet realize say di infernal heat from hell na MY temper wey don  pass di boiling mark? There is no gauge wey go fit measure either MY almighty love and no gauge go fit measure MY almighty wrath. You no go fit  measure both of dem becos na without measure.
To Warn You In Advance Na For You To Be Prepare For Such A Time As DIS! Mankind dey about to experience MY wrath, but na dis earth go suffer, no be di other planets. Becos na true say you dey live ontop of Hell. Hell dey deep under di ground, but you dey waka ontop of Hell you dey waka ontop of where di demons dey live, and for where souls dey suffer endless torment. No be why be say you dey constantly bombarded to sin in some way or another?

To Warn You In Advance Na For You To Be Prepare For Such A Time As DIS! Only di RUACH ha KODESH (HOLY SPIRIT) go fit help you to walk Holy and only di life and Blood wey YAHUSHUA give at Calvary for your sins, can wash away your sins. Only by believing say YAHUSHUA resurrect on di 3rd day can you have faith to believe say YAHUSHUA na Almighty God and SAVIOUR. MY only begotten Son wey a virgin Miryam (Mary) carry for her belle. Where is your faith?

To Warn You In Advance Na For You To Be Prepare For Such A Time As DIS! Volcanoes na di entrances to Hell but di souls wey dey Hell no go fit escape and  no one go fit  stay alive to see Hell for their physical form. I don show some people little piece of Hell as Bible talk about di rich man and Lazarus, and no no be just symbolism or parable. I no originally create Hell for Humans but instead for satan and his fallen angels, but I don give Human being di choice where dem want to spend eternity. Wetin you go do with that choice?

To Warn You In Advance Na For You To Be Prepare For Such A Time As DIS! Those wey mock people wey warn of Hell, di Lake of FIRE dey wait for dem. Becos those wey go fit believe say I create a Heaven wey dey so beautiful that words no go fit describe am and know say di only door to Heaven na thru di gift wey I give Mankind thru Calvary, YAHUSHUA na MY Beloved Son Name, YAHUSHUA na di only door, there is no other door to Heaven. No other way to MY throne of grace, No no be Buddha, or Mohammed, becos dis na just ordinary men wey die and no arise again. Dis na just ordinary men wey no fit be di only perfect Lamb of God without stain to make atonement for sins. YAHUSHUA na di only perfect sacrifice and that na becos HE is di Son of YAHUVEH and MY only begotten son.

To Warn You In Advance Na For You To Be Prepare For Such A Time As DIS! I give MY Son, MY Beloved Son to be human being wey dey earth sacrifice becos na earth I pity. Becos na for earth where I cast Lucifer out of Heaven. Becos of MY mercy and love knowing how angry Lucifer was and is, I had to make a way for MY Children on earth to once again be reconciled with their Creator. Lucifer dey cause great grief and great persecution becos una actually dey living on top of Hell wey I created for Lucifer wey now be satan and his demons. You dey surrounded with evil wey dey come up from below di ground, also as di princes, powers, principalities, and rulers for di high places, in di air, demonic spirits wey dey gather together like military to assault dis planet with every kind of sin, and sin na anything wey be di opposite to MY nature, personality and MY will. “All have sinned and fall short of di GLORY of God.”
To Warn You In Advance Na For You To Be Prepare For Such A Time As DIS! You are surrounded with a cloud of witnesses wey dey watch wetin you do with MY Son YAHUSHUA. For all di planets na only one planet, which is called earth need a Savior, for I have only one Begotten Son, and HIS Name na YAHUSHUA. There is only one planet with sinners. Sin dey come becos you dey live ontop of Hell and all have sinned and fall short of MY glory. I am Almighty God perfection. To say you no be a sinner mean you are a liar, becos no person on earth dey perfect, except one and that na when MY Son YAHUSHUA waka for di earth.

To Warn You In Advance Na For You To Be Prepare For Such A Time As DIS! MY anger don greatly rase up, and go pour out in greater amount thru di storms, hurricanes and tornadoes, and as “I AM” hit MY fist on di earth e go crack open to a greater measure, and as MY anger fire up na so di volcanoes go also fire up and also Hell too. MY Children wey dey love and serve ME dey put ME first for their lives; know how to calm down di anger of a FATHER, becos no be with dem I dey angry. Dem no need to fear, their destiny no be to suffer MY wrath, but only MY Love. Their destiny no be to suffer MY curses, only MY Blessings.

To Warn You In Advance Na For You To Be Prepare For Such A Time As DIS! I warn you of wetin go happen for MY Word when human being dey play God becos that na all dem go fit do na play. Dem no understand say for dis dem go pay as dem dey seek to become a God a creator, Dis God of Creation go show dem becos I go take di very knowledge given to them and turn am against dem.

To Warn You In Advance Na For You To Be Prepare For Such A Time As DIS!  Be warned when dem clone person, they are born without a soul and any creation without a soul is a dangerous thing. Becos human being suppose to have a soul, I blow di breath of life into Adam, but when human being creates clones of Adam and Eve, I tell you dis there will be no breath of life for inside dem. Instead e go be di breath of di soulless one, satan go be di father and evil go be di reward for playing God. Dis clones no go get di years of life as MY creation, and dem no go get di desire to serve and worship di God “I AM!” Dis clones no go get any conscience becos na ME be humanity conscience of wetin dey right and wrong. Dis clones go turn on di very creators and on humanity wey allow such evil creatures.

To Warn You In Advance Na For You To Be Prepare For Such A Time As DIS! Be careful when you eat meat wey no get soul; you dey eat meat wey I no create. Your body was not supposed to be so defiled. When you see sickness and diseases wey new and your Doctors no fit heal am, I go say Doctor heal yoursef becos if that Doctor no stand up and say, “No dis dey against di laws of creation” then I go turn creation against itself. You have been warned!

To Warn You In Advance Na For You To Be Prepare For Such A Time As DIS! Di scientist know say di years of life of a clone dey short, but dem dey find how to bring am back if after e don die (di devil go fake di rising of di dead in a moment, in di twinkling of an eye, at di last trumpet. For di trumpet go sound, and those wey don pass away go raise up from di dead with body wey dey holy and perfect, and we go change 1 Corinthians 15:52. Na dis we dey tell to you by di word of di Messiah, say we wey dey alive and remain until di coming of di MESSIAH no go by any means go before those wey dey asleep. For di MESSIAH HIMSEF go come down from heaven with a shout, with di voice of an archangel, and with di trumpet of God. And those wey don die in di LORD YAHUSHUA go rise first. Then we wey remain wey dey alive go catch up together with dem in di clouds to meet di Messiah in di air. And na so we shall always be with di Messiah. 1 Thessalonians 4:16-18). Dem dey lookhow for to use dis clones like body shop spare parts. Di horror as di cloud of witnesses dey look on and shake their heads in disbelief. Innocent babies wey still dey inside their mother womb and yet dem tear dem out and murder dem before di time of their birth for di sake of convenience and also for body parts. Again if to say no be di price wey MY Son YAHUSHUA don pay I for regret ever creating humanity.

To Warn You In Advance Na For You To Be Prepare For Such A Time As DIS!! Becareful becos there is coming a time wey to live near graveyards you go see di enemy raise up di evil dead ones wey go dey without spirit becos their spirit go dey for Hell dey suffer, but di body go raise from dead and use by demons wey dey come out from di bottomless pit to do one thing and that na to kill and for di evil spirits to come out of di soulless ones enter human bodies with souls, to further contaminate MY creation of human kind. Even di pet animals will be a danger for that time.

To Warn You In Advance Na For You To Be Prepare For Such A Time As DIS! But MY Children wey dey now hear di warning go know to call upon di Name of YAHUSHUA ha MASHIACH, and in HIS Name pick up wood and hit dem for their neck becos dis evil dead get  weakness becos na evil spirits, demons wey no get souls from di bottomless pit nain raise di evil dead  enter their body, di neck dey supports di head, but MY Son pay di price on that cross of Wood and that wood symbolize di cross wey defeat satan on that day.

To Warn You In Advance Na For You To Be Prepare For Such A Time As DIS! Wetin I no reveal before  be say no be just any piece of wood but instead wood wey you don anoint with anointing oil, prayer and faith that just as surely as YAHUSHUA, overcome di cross and although say he die he rise up again on di 3rd day, na so too your faith go dey strong to know say di Wood wey you anoint with oil represent di victory wey I give you at Calvary, over di devil and demons. When you hit dis demonic creatures wey come back out of di grave, wey disguise demsef as human being, you go see dem crumple to di ground, when you hit dem in MY Son YAHUSHUA’s Name. How can you expect to kill dem with ordinary weapons when dis na spiritual war? Human weapons go only multiply di demonic walking dead. Your weapons wey you take dey do warfare no be ordinary human weapon but Spiritual and di wood represents something wey dey spiritual.

To Warn You In Advance Na For You To Be Prepare For Such A Time As DIS!! Pray that you no go dey worthy to suffer MY wrath on dis day, pray that you go dey safe at MY bosom on dis day. Becos dis world dey only think say dem don see horror stories dem no realize say satan dey even laugh at dem now becos wetin you think say na ordinary scary movie na actually wetin di devil intends to do, for he comes to lie, steal, kill, and destroy and everybody on earth na satan target. Even those wey dey call upon satan no realize say even though satan go share some of his power with dem, he only allow dem to use am on others as well as on demsef to manipulate, intimidate, cause fear, kill and destroy.

To Warn You In Advance Na For You To Be Prepare For Such A Time As DIS!  Satan hate even those wey dey worship am. He no get respect for any persons, because all of humanity  is made in MY image, and MY Son YAHUSHUA was born in di image of a man, and make a open show at HIS resurrection, by mocking satan and everything wey satan don try to do. YAHUSHUA give HIS power to HIS children wey dey call upon HIS Name and worship, love and serve YAHUSHUA! Satan hates MY Children becos dem also get that same power to destroy di works of di devil. Even those wey dey mock YAHUSHUA still dey made in di form of human being and di devil know of dis and go one day punish dem becos dem be MY creation. You no go fit please di devil. No matter who that person be, he no get any favorites and e go take everybody to hell that he can. Satan know his future but he want am to be humanity future also.

To Warn You In Advance Na For You To Be Prepare For Such A Time As DIS!  Dis na why I send MY only Begotten Son to be your ransom, Becos na true say I require a price for sin. Di Blood Sacrifice wey go only fit to calm MY anger has to be Holy and undefiled, and YAHUSHUA, MY Son volunteered to be your Blood atonement. Wetin you do with that Blood atonement and MY Son and di Word that was made flesh. Study and show yoursef approved so that you can stand in di days wey dey come, hide am inside your heart, where no man go fit steal am. Do dis now before it is taken from you.

To Warn You In Advance Na For You To Be Prepare For Such A Time As DIS! Ask for MY Blessings on everything wey you eat or drink. Becos nothing dey without contamination anymore, but na di blessings wey you speak in di Name of YAHUSHUA nain go make wetin dey unclean to be clean, and make wetin be a curse into a blessing.

To Warn You In Advance Na For You To Be Prepare For Such A Time As DIS!  For those wey believe say Hell no dey real, dem go soon test di infernal fires of Hell wey no be like any fire for earth. You no go fit describe di horror of hell, just as you no go fit describe di beauty of Heaven. For those wey believe say dem go dey here in di tribulation and that I no go make a way to save dem, where their faith is na there their tribulation go dey. In all ways remember dis “It is impossible to please YAHUVEH without faith.”

To Warn You In Advance Na For You To Be Prepare For Such A Time As DIS!   Be careful of a government wey go say, “Make you do things their way and not in Almighty YAHUVEH’s biblical way!” Be careful of anyone wey say di Bible is now outdated, no matter what denomination speak am. Di Word of YAHUVEH cannot lie and I don give enough proof to dis earth say wetin I dey speak dey come to pass or don already come to pass.

To Warn You In Advance Na For You To Be Prepare For Such A Time As DIS!   To warn you in advance na to make you prepare. Any apostle or prophet or spiritual leader wey tell you say “I AM”  no be di same yesterday, today, and forever, wey tell you make you no believe di Bible say na ordinary out of date  book full of stories, and although say na interesting book  but e no matter for dis our times, any spiritual leader wey go tell you say satan  no be real enemy or be only picture of your imagination.

To Warn You In Advance Na For You To Be Prepare For Such A Time As DIS!   Di evil ones say di commandments no matter anymore and make you no longer feel any conviction when you ignore MY set Sabbath day wey dey for di book of Genesis since di creation of man, or make you no fear when you break MY commandments. Instead di evil spiritual leaders dey rewrite MY commandments, and rewrite di Holy Word according to their lifestyles. Dis evil spiritual leaders dey play God and dey insist on taking YAHUVEH’s glory and reverence  wey belong to “I AM” and MY Son YAHUSHUA and MY RUACH ha KODESH.

To Warn You In Advance Na For You To Be Prepare For Such A Time As DIS!   Dis evil spiritual leaders are to be openly rebuked, avoid dem and run from dem. Any spiritual leader wey tell you dis dey send lies straight from di pit of Hell. Di evil ones say YAHUSHUA is not perfect, and say any religion and serving any God is better than none. Di evil ones say any doctrine will be acceptable with di Elohim of Creation or say Jews go automatically just go to Heaven, even if dem hate YAHUSHUA and refuse to accept HIM as MESSIAH and Elohim Almighty! Or di lies wey Moslems, Buddhists or any other religion wey dey serve and call upon any other name will be saved. Be careful of anyone wey dey teach say reading and studying di Bible no dey important, say other books dey of more value. How you go take know YAHUVEH, wey create you and deliver you if you no read MY Book and meditate on MY Promises?

To Warn You In Advance Na For You To Be Prepare For Such A Time As DIS!    “I AM” dey speak now and dey warn you in advance  that any spiritual leader wey dey teach you to sin na from di evil one wey dey look for your destruction and for your soul. Again to warn you In advance na for you to be prepare for Such A Time as dis!

Dey Offend some dey enlighten others in di Name of YAHUSHUA ha MASHIACH Apostle Elisabeth Sherrie Elijah (Elisheva Eliyahu)
9:00 pm cst 4/21/01
Confirmation Dream about Contaminated Meat: Dream on 4.23.01. “Me and Apostle Elisabeth (Elisheva) go into a fast food restaurant, Popeye’s Chicken to be exact. We go there and we buy 2 piece of chicken dinners. When I get our orders, there for di Popeye’s box dem print ‘made with artificial ingredients-may cause side effects’. I look at di red, white and blue Popeye’s box and we was shock to see say even chicken dey make everybody sick.” Di interpretation was given to Elisabeth (Elisheva) say di chicken was contaminated and di Popeye’s box confirmed say dis na America dey do dis to us, becos of di red/white/blue color design.