Prophecy 52 I, FATHER YAHUVEH, GO DELIVER YOU ONCE AGAIN


Prophecy 52
I, FATHER YAHUVEH, GO DELIVER YOU ONCE AGAIN!

Given to Rev. Elisabeth Sherrie Elijah (Elisheva Eliyahu)
on November 2, 2001

HEAVENLY ALARM CALL FOR DI ONES WEY I DON HIDE
Dis na from Prophecy 105, YAHUVEH say to put dis on top of every Prophecies from now on: 
I warn you a long time ago Elisabeth [Elisheva], make you no call dis Ministry after a man or a woman name.
Even before dis Ministry start, I put am for your spirit. Becos nothing wey dey here come from your hand. Nothing wey dey here commot from your mouth. Na from di Mouth of YAHUVEH dis take come out. Na from di Mouth of YAHUSHUA, your MASHIACH, nain dis take come out.
Na from di Mouth of di RUACH HA KODESH, your IMMAYAH, nain dis take come out. If to say na by your hand e for don fail long time ago. Na by di SHKHINYAH GLORY Wind
wey dey blow across dis earth, di HOLY Wind of Revival. No be by your breath, or e for don fail.    
Isaiah 42:8

For July 2010, YAHUVEH GOD also say to add dis one as a warning to those wey dey mock:

But dem mock di Messengers of GOD, no gree to hear HIS Words,
and no take HIS Prophets seriously, until di Wrath of YAHUVEH
arise against HIS People, untill there was no more mercy.
2 Chronicles 36:16

* * * * * * *

Prophecy Begins


Dearest Beloved Children of MINE, how many of una dey cry out to ME with shouting and tears and you dey try to hide your fears from di world and your friends, yet make you trust in your Daddy YAHUVEH and MESSIAH YAHUSHUA. You dey come to us with faces wey get tears in di Name of MY Son YAHUSHUA you dey say, “Wetin we go do now? Where we go go now?” Darlings of MINE, oh I no dey angry with you at dis time, na di evil ones nain I dey  very angry with. I see di evil ones as dem dey plot§ and plan, and na just like in di time of old with di serpent for di Garden of Eden, looking to deceive you, and to make you think say you cannot win without worldly knowledge. Your Father ME, YAHUVEH, na all of knowledge and when you seek ME, YAHUVEH, and YAHUSHUA and di RUACH ha KODESH you dey seek truth, and knowledge.

Be very asure, as long as you dey seek ME, you go find di answers when di time come. If you no  know wetin to do, then be asure, na becos no be yet di time for you to know where to go, or wetin to do. ME, YAHUVEH, no go give you di ticket to ride until na di time to leave. ME, YAHUVEH, I am never too early or too late, but I am always there right on time. Not a second to waste sometimes. But ME, YAHUVEH, will never leave you, or forsake you. ME, YAHUVEH, I AM di Creator of all mankind. You no need to fear wetin di evil ones go do, Becos ME, YAHUVEH, dey use di simple things, like your prayers, to suprise di so-called, wise of dis world.
ME, YAHUVEH, I can even change your DNA. Did you know that? Yes, if I so choose am. ME, YAHUVEH, can even change di color of your skin and your eyes. No let am surprise you. ME, YAHUVEH, I AM di Creator remember? ME, YAHUVEH, I dey able to make you invisible if I, YAHUVEH, so choose am. You no get any idea di kain standard I go raise up against di evil ones. Di very bondages, diseases, and plagues wey di evil ones, wey be satan children, seek to loose upon you, go shock dem. Multitudes of MY Children will not be harmed. Instead, di evil families of di evil ones nain go get di diseases and di plagues, and dem no go get any answer as to di reason why. All dem go have to admit na say ME, YAHUVEH, nain do am.

Di evil ones dey hussle to protect demsef, and dem think say dem dey wise to even vaccinate their own families, and loved ones, and friends, and yet, ME, YAHUVEH, go cancel that protection. To di amount wey di evil ones, di pretenders, seek to harm MY Children, na di same amount that di harm go come back upon dem. Start praying for dis now. There is great power in prayers to ME, YAHUVEH, in di Name of your MESSIAH, MY only begotten son YAHUSHUA. Pray say make, ME YAHUVEH, go give you greater spiritual weapons to use against di carnal ones wey dey rise up against MY beloved ones, wey dey seek MY face and MY will every day.
Pray say as Elisha take see di mantle fall from Elijah of old, na so you go also see am again, and you go dey filled with even more of di RUACH ha KODESH anointing power. When dis go happen, you no go need to be concern how you go get to a certain country. When ME, YAHUVEH, send you, you go just appear. Do you think dis is strange? Read your Scriptures and see how many already use di power of disappearing and know say di evil ones dey already use dis kain powers for evil purposes.

The evil ones dey keep dark secrets, and yet ME, YAHUVEH, go tell MY secrets to those wey dey follow di guiding light, who is YAHUSHUA. ME, YAHUVEH, go protect MY Babies, Bride, Chosen Ones, and Elect! YAHUSHUA na like a lamp unto your feet. When di evil ones take your light away, look to ME, YAHUVEH, and I go send MY angels to light your way. Di evil ones dey seek to take your confidence, faith, trust, truth, privacy, freedoms, happiness, joy unspeakable and full of glory, and your finances, away from you. Dis dey easy for dem to do if you listen to di spirit of fear, and all di bad reports for news. More than you listen; read di good reports, dem dey written in di Scriptures. At least MY Children put everything in balance. How can you hope to defeat fear when everything wey you dey do na feeding di fear madness?
MY Children wey I don hide have di knowledge, and a way around every weapon of di enemy wey dey seek for MY children destruction, and dis world destruction. Make you no put your trust for your own understanding, but in all of your ways acknowledge ME, YAHUVEH and I, YAHUVEH, go direct your paths. Your own understanding go cause you to fear wetin you no know. ME, YAHUVEH, do not sleep. ME, YAHUVEH, no dey tire or rest. MY eyes dey for di country where MY People dey cry out to ME in prayer to save dem. No listen to di doom and gloom lying prophets. Dem dey speak and write say ME, YAHUVEH, no go provide a place of escape for MY beloved ones wey dey follow YAHUSHUA ha MASHIACH and wey dey do their best to obey MY laws. Why do MY Children seek to obey ME, YAHUVEH? Because dey love their Heavenly Father.

Di lying prophets dem don crawl into di positions of di five-fold offices of di churches, and of di politicians, and di newscasters. Dem dey speak fearful things to MY Children. Dem dey speak of defeat and not of victory. Dem dey plant doubts inside your minds whether ME, YAHUVEH, go rescue MY Children. Dem dey warn say everybody must be prepared to be attacked, everyone go die or go suffer heavy casualties, without ME, YAHUVEH, and YAHUSHUA ha MASHIACH on your side, dis na true. Wetin di newscasters and many politicians, and di lying prophets forget na say ME, YAHUVEH, never forsake MY Children. How will that bring ME Glory? Yes, MY Children go one day join ME in Heaven, dis is true, but if to say I no want to provide a way of escape, why I go say so in MY Scriptures? MY Word no go return back to ME empty, e go accomplish di thing wey I purposed am. I AM YAHUVEH and I no dey change.
Wetin ME, YAHUVEH, do for Israel in di time of Moses; I go do am again. Wetin I do for Lot; ME, YAHUVEH, go do am again. Wetin I do for Joseph and Mary; ME, YAHUVEH, go do am again. Wetin I do for Noah; ME, YAHUVEH, go do am again. Wetin I do for di three Hebrew children; ME, YAHUVEH, go do am again. Wetin I do for Elijah of old; ME, YAHUVEH, go do am again. Wetin I do for Enoch; ME, YAHUVEH, go do am again. Wetin I do for Elisha; ME, YAHUVEH, go do am again. Di place wey Haman build; ME, YAHUVEH, go hang dem for there. I have an Esther and just as in di times of old, ME, YAHUVEH, go deliver MY People again. I have a King David and shall use music and praises to defeat di enemies as Psalms are once again lifted up to ME in faith wey ME, YAHUVEH, go deliver again.

Show ME for your Scriptures where I no deliver MY People that follow MY commands and wey dey love and put ME, YAHUVEH, first in their life? ME, YAHUVEH, go deliver MY Children from di trap of di trapper. All you have to do na pray and have faith and believe say I AM greater than all dis fearful things wey dey try to come upon MY Children! ME, YAHUVEH, go answer your prayers when you call to ME in di Holy Name of YAHUSHUA ha MASHIACH. Come boldly before MY throne, and give ME your request. ME, YAHUVEH,  no dey angry with MY beloved children. some times you go astray, disobey, and di wolf dey ready to eat you, all because you no obey. So like sheep, You force ME to break your leg, but then I lovingly carry you in MY arms until you heal and are able to walk again. For where you ever see where a Good Shepherd ever leave his sheep unattended? For where wey a Good Shepherd dey beat di Sheep and Lambs? Never! But I do promise I go make di ones wey dey seek to destroy you regret di day wey dem born dem.

Did I, YAHUVEH, not warn Lot and block am with MY angels so that him no fit renter back into di city of sin? I protected him, and his family, except his wife, wey chose to disobey ME, from di fire and brimstone, which was a form of tribulation for Lot and his family also. Did I, YAHUVEH, not warn Joseph and Mary to run with YAHUSHUA as a babe? In di times of old, that na a form of a great tribulation for di mothers wey get babies, becos dem kill all di babies, becos di evil ones dey seeking to find di true Messiah to kill HIM! ME, YAHUVEH, send an angel to warn Joseph for dream, and to tell am where to run to and tell him when to come back. Do you think say ME, YAHUVEH no go do di same for you?

Did I, YAHUVEH, no provide a ark for Noah and his family before that great tribulation of water wey flood di earth? What about Esther? You no think say that  na a form of tribulation to see di Jewish people killed all around her and yet did I, YAHUVEH, not provide a way of escape for di Jewish people, or there for be no one Jews today? Did I, YAHUVEH, not use di very weapon wey dem plan to take kill Mordecai and Esther, di post wey Haman build, wey him think say him don trap Mordecai and Esther, and all di Jewish people would be killed and yet ME, YAHUVEH, hang Haman on di same very post.

How can di very ones wey claim say dem  dey hear prophecies, deny say ME, YAHUVEH, have always had a way to protect MY People. Beware of  di ones wey dey prophesy dis things wey dey make you feel hopeless. No matter wetin be di tribulation, ME, YAHUVEH, go provide a way of escape for those wey dey trust and rest on ME in all their ways. Trust more in YAHUVEH, and your YAHUSHUA, than your wife, husband, friends, five-fold offices or government.

ME, YAHUVEH, no go promise you say e go be a easy road for everybody. I no go promise you say people no go die martyrs wey go lay down their lives for YAHUVEH and YAHUSHUA. I go promise you say dis martyrs dey for Heaven with ME right now and never again will they suffer. I no go promise you say I go hide all MY Children, but ME, YAHUVEH, go protect dem like I take do di children of Israel in di time of old, when di plagues, and di darkness, and death come upon dem. I save those wey have di blood of MY covenant in di times of old, how much more wey I go do am now with di Blood of di new covenant of YAHUSHUA ha MASHIACH.

I warn you enemies, I go expose you. My sheep go know your names and your plans. ME, YAHUVEH, dey see and know each person with di heart of a evil beast. ME, YAHUVEH, and YAHUSHUA alone na di Good Shepherd. ME, YAHUVEH, alone go suprise you evil beast with your own weapon of war and things wey you create. ME, YAHUVEH and YAHUSHUA na di Rod of wrath wey go beat you away from MY Sheep and Lambs. Be not deceived, I go kill di evil beast in MY timing and cast dem not only into hell, but into di Lake of Fire! To all those wey dey seek di destruction of America, Israel and all di Christians and di Jews, wetin be di price of your soul? If you continue to do dis, then your soul will be eternally damned! If you turn away from dis evil, and turn to YAHUSHUA ha MASHIACH then you will be eternally saved. Na your choice.

* * * * * * *

Dis message dey offending some people,  and e dey enlightening others for di love, obedience and glory of YAHUVEH and YAHUSHUA.
Prophetic Woman Servant of YAHUVEH and YAHUSHUA, Apostle Elisabeth Sherrie Elijah (Elisheva Eliyahu). Friday 11/02/01, at 1:50 am.
Pray say make you find out where for dis world your ark dey and when you are to enter am to escape di evil wey dey come. Pray in di Holy Name of YAHUSHUA. Miryam (Mary) no give her Hebrew baby a Greek name ‘Jesus’. There is anointing power in di Name wey mean YAHUVEH saves.