Prophecy 56, WARN DEM! HOW FEW GO LISTEN


Prophecy 56
“WARN DEM! HOW FEW GO LISTEN!”

Given to Apostle Elisabeth Elijah (Elisheva Eliyahu)
June 5, 2002

FIVE STATE WARNING:
California, Nevada, Texas, Arkansas, Missouri

Elisabeth (Elisheva) hear di sound of dis words from di LORD before HE speak thru her with dis warning!

* * * * * * *

Dis na from Prophecy 105, YAHUVEH say to put dis up for all Prophecies from now on: I warn you a long time ago Elisabeth [Elisheva], make you no call dis Ministry after a man or a woman name.
Even before dis Ministry start, I put am for your spirit. Becos nothing wey dey here come from your hand.Nothing wey dey here commot from your mouth. Na from di Mouth of YAHUVEH dis take come out. Na from di Mouth of YAHUSHUA, your MASHIACH, na dis take come out.
Na from di Mouth of di RUACH HA KODESH, your IMMAYAH, na dis take come out. If to say na by your hand e for don fail long time ago. Na by di SHKHINYAH GLORY Wind
wey dey blow across dis earth, di HOLY Wind of Revival. No be by your breath, or e for don fail. Isaiah 42:8

For July 2010, YAHUVEH GOD also say to add di following as a warning to those wey dey mock:
But dem mock di Messengers of GOD, despised HIS Words,
and no take HIS Prophets serious, until di Wrath of YAHUVEH
arise against HIS People, till there was no remedy.
2 Chronicles 36:16

* * * * * * *

Prophecy Begins


I send MY Prophets forth to warn of MY judgments. I send MY apostles and prophets forth to warn before di doom go come. I warn those now, for America thru dis Woman Servant of MINE once again. I give her a dream. Now! Urgent! Intercessory prayer warriors for di five states wey I mention for dis dream [California, Nevada, Texas, Arkansas, Missouri] must rise up. I tell her at di time when she was di most vulnerable, when her ear dey open, and ready to hear MY words. Two words: Warn dem! Warn dem when America go dey most vulnerable. As a plane was flying low, like for di dream wey dem go described below. Dis five states dem dey most vulnerable. If enough prayer warriors no rise up and care, attack go come. I no go say how, I no go say when. I warn thru MY Prophets. How few go listen.

Di people now dey take di warnings of di government no longer seriously, becos dem don give so many. But Missouri, Arkansas, Texas, California and Nevada, ‘If MY People who are called by MY Name no humble demsef, fall on their faces and repent for di sins wey dey dis land,’ dis five states go feel di wrath of Almighty GOD YAHUVEH’S hand.

But MY Children wey dey inside di arks, di ark na wherever I don put you to stay as dis evil passes by. I tell you dis: anoint your houses, anoint your doors, for just like di days of old, just as when di plagues come, di children of Israel were safe. Those wey dey worship other gods were not safe. Di angel of death pass dem by and no touch di children of Israel. But those wey dey worship other gods, those wey dey serve no god feel di hand of Almighty GOD YAHUVEH’S wrath. Na ME dey allow dis to happen.

I let MY Daughter be di one to warn you. How few go listen. You have been tested as I don repeate again and again say, as Elijah of Old [in Hebrew, Eliyahu] take test di widow of Zarephath and others. Di prophets of Baal go fall. I go send judgment down on those wey no take MY warning seriously. No blame any man, becos dis thing will be allowed by di hand of di CREATOR, of di SAVIOR. Becos you no want to listen to US in any other way. Repent, fall on your knees and pray that judgment no go come down on you dis very day, becos your harden your hearts, becos you deaf your ears, becos you blind your eyes.

Your churches dey make ME vomit. Your worship dey make ME to close MY ears. You better call on ME now while you fit still find ME. Away with your hypocrisies, away with you scribes and Pharisees, you wey know di letter of di law but you no get di love inside you, away from ME. I no call you MY Children, I call you MY enemies. No think say YAHUSHUA no go speak like dis, becos I call dem snakes and vipers. You inject your venomous poison inside those wey dey serve ME. You try to kill dem with di letter of di law. You throw out MY grace and mercies; therefore you no go have any of MINE.

Elisabeth Title dis Prophecy [Elisheva], Warn Them! Those wey dey mock you wey dey say, “Oh you don dey warn of judgment every day. Warn dem! Just as in di days of Noah, how few pay attention until di flood come. Just like di days of Sodom and Gomorrah. No one pay attention until it was too late. Warn dem! America, you think say you dey fly so high. But you no understand, becos only one purpose I have protected you, America, and that na becos of those wey dey call out in MY Name and pray say, “Save America, give America more time!” But where is di repentance, America? Where is di covering of your face in shame? Becos di atrocities still dey go on and di Name of MY SON dem dey damn.

Warn dem MY Daughter. Do not be surprised how few go listen, do not be surprised how many go laugh at you. Dem see di true ministers like your, like you and di other ministers. And dem see di ministries dey go in lack. Dem dey feed their own faces. Dem no care of those wey be MINE. Now di time dey come and hunger shall be in their bellies, no roof go be over their heads. Maybe not today, but e go be when dem least expect am. I go close MY ears to their cries. Those wey hate MY Sabbath day. Warn dem, MY Daughter.
I don use dis ministry to test di metal of di people. People you don fail, I call those wey dey worship ME, wey dey serve ME faithfully day by day, wey dey pray so much dem no go fit count di hours in di day, to test di metal of di people. Di people have been found wanting, di people have been found without compassion. So warn dem, MY Daughter. Dem go mock and dem go laugh. Dem say wetin you prophesy never come to pass yet. Dem forget say even di prophetic warnings for Revelation never come to pass yet, no be to di degree wey you don see so far.

When I have mercy, dem throw di mercy back in MY face. When I have mercy, becos di prophets pray, “Please no do am now,” becos when I have mercy and di people rise up and pray, then MY Apostles and Prophets dem brand dem false becos I no loose judgment that day. Warn dem, MY Daughter. Do not be surprised how few go listen. Warn dem, MY Daughter so that di blood no go be on your hands. Tell dem di dream below, but dem no understand, becos their ears dey deaf. Satan deon fills dem with wax. Their eyes dey dim, satan don cover their eyes. Their mouth can only speak lies and insult and destruction to those wey I say be MINE. But those wey be MINE dey sealed; those wey be MINE dey protected. But warn dem, MY daughter, so that dem no go say I no warn dem, say I no send an apostle and a prophet to warn dem to repent and pray.

Why be say America think say dem dey better than any nation on earth? I go tell you dis, Prayer Intercessors. Those wey fervently dey pray dem better get in touch with you from dis five states [California, Nevada, Texas, Arkansas, Missouri], for those who will be raised up from other places around di world, you know your calling. Na for a Prayer Intercessor. Come forth now! Contact dis Apostle before e go too late. Becos America, you dey get ready to celebrate another birthday and becos of MY mercy and love, I don show you compassion and I now send again an Apostle to warn dem. Pray once again that MY judgment on America will be delayed.

* * * * * * *

Na as YAH speak am thru di Prophet Elisabeth Eliyahu, na so dem write am down, for under di anointing of di RUACH Ha KODESH, given to Apostle Elisabeth Elijah (Elisheva Eliyahu).